Mahmood Yakubu

From Wikipedia
Mahmood Yakubu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am1962 Chenj-am
Ples wey dem bon amBauchi state Chenj-am
Wok wey e dey duprofeso Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Oxford, Category:Alumni of Wolfson College, Cambridge Chenj-am

Mahmood Yakubu (dem bon am for 1962) na Naija professo an e bi di oga of INEC ( Indipendent Nashonal Eletoral Komishon).

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Bauchi Stet dey bon Mahmood Yakubu in 1962. Bauchi Stet de di Norta pat of Naija. Yakubu go Kobi Pamari skul for e pamari edukeshon an Govamet Tisha Kolej, Toro for e sekondiri edukeshon.

Yakubu kom go Usmanu Danfodiyo Yunivasiti wey e tek rid History. Yakubu finish from di Yunivasiti in 2015 with fest-klass digree. As at 2015, na onli Yakubu wan kari fest-klass komot from di dipatmet of History from Usmanu Danfodiyo Yunivasiti. Yakubu go do e Masta Digree for Wolfson College, Cambridge an e finish am in 1987. Yakubu do e Ph.D in Naija Histri at di Yunivasiti of Oxford wey e tek finish in 1991. Na Bauchi Govamet sponsor am for Yunivasiti of Cambridge an Yunivasiti of Oxford wey e go rid.

Yakubu do well so tey e win Ovasee Risach Skolaship three times. "Association of Commonwealth University" give am Commonwealth Skolaship too.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yakubu na leshoral , pesin wey sabi "guerrilla warfare" tins, an professor of Politika histri an intanashonal stodis at NDA Nigerian Difens Akedemi

Bifor Yakubu bikom oga patapata for INEC, forma presidor Umaru Musa Yar'Adua don chuz am to bi di ezekutiv seketiri of TETF ( Tertiary Education Trust Fund).Na for 2007 forma presidor chuz am for di posishon.

Yakubu bifor don wok as hasitat Seketiri of Finans an Administrashon for di 2014 Nashonal Konferens , Nigeria. In 2013, dey give Yakubu honorari feloship to di "Nigerian Institute of Public Relations".

INEC[chenj-am | chenj-am for orijin]

Forma Naija presidor Muhammadu Buhari chuz Mahmood Yakubu as oga patapata for INEC on 21 October 2015. Yakubu tek-ova from Amina Zakari. Amina Zakari dey wok as hatin chairman of INEC dat time.

Wie dem gada do tori[chenj-am | chenj-am for orijin]