Luvsannorovyn Erdenechimeg

From Wikipedia
Luvsannorovyn Erdenechimeg
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromMongolia Chenj-am
Wen dem bon am1957 Chenj-am
Ples wey dem bon amUlaanbaatar Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokMongolian Chenj-am
Wok wey e dey ducomposer, ethnomusicologist, visiting scholar, musicologist Chenj-am
Wu e dey wok forIndiana University Chenj-am
Wie e go skulMoscow Conservatory, National University of Mongolia Chenj-am

Luvsannorov Erdenechimeg (dem bon am for 1957) na pesin wey dey stodi how difren difren kolsho dey mek muzik an how di muzik dey du pipul wey lisin to am. E na risasha.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Ulaanbaatar, Mongolia dey bon Erdenechimeg in 1957.Erdenechimeg kom from di famili wey like to stodi langwej an rekod how pipul dey du tins for lokal way. Erdenechimeg risach wok na stodi on old Asian muzik histri. Erdenechimeg bi visiti professor at di Indiana Yunivasiti, Dipatmet of Sentral Eurasian Stodies from 2005 go rish 2008.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Erdenechimeg get e bashelor digri in Muzik from di Muzikal Kolej in Ulaanbaatar, Mongolia in 1978. E kolet e Bashelor an Masta digri at di Tchaikovsky Konsavatori (wit Dr.Pr. Yuri Nikolaevich Kholopov) in [[Moscow, Russia from 1980 go rish 1986. Erdenechimeg rid Muzik at di Shanghai Konsavatori (wit Pr. Chen Ying Shi) from 1997 go rish 1999. Na two Ph.D Erdenechimeg get.Di Pepa wey e rait tek kolet di fest Ph.D na "The Consonant and Dissonant Sounds of the Harmony of the Horse-headed Fiddle" for di Mongolian Nashonal Yunivasiti of Art in 1993. Di sekod Ph.D pepa wey e rait na "The Harmony of the Mongolian Meditation Guru Song " for di Mongolian Akademi of Sayens in 2000. Sins 2000, Erdenechimeg don bi Assosiate Professo in di Dipatmet of Muzik Tihori of di Mongolian Nashonal Yunivasiti of Art.

Buk wey e don rait[chenj-am | chenj-am for orijin]

Erdenechimeg don rait ova 15 buks on muzik an muzik wey kom from Mongolian. Meni of e buk dey intaprit to Chinese, Russian, an Inglish. One of e buk "Eighteen songs of a Nomad Flite" bi di fest old Chinese buk wey dey intaprit to Mongolian. Di buk kom out in 2002 an bikos of how pipul like di buk, dey print di buk again in 2003. Dey mek di buk into three langwej, Chinese, Mongolian an Inglish an Erdenechimeg stil add some niu tins like how di poem tek konet wit di instrumental Muzik, song, art, an drama. Di Mongolian komposa Tsogzolyn Natsagdorj yuz di buk du e stage Muzik show.