Jump to content

Louise Manny

From Wikipedia

Louise Elizabeth Manny (dey bon am 1890 an e Kpai 17 August 1970) na New Brunswick wuman wey dey stock an rekod how dem dey du tins for lokal way an e stil bi pesin we dey stodi histri. Na for Gilead, Maine dey bon am but e famili go stey for New Brunswick wen e bi three years old. Na for Miramichi Riva side e tek gro up an from dat side e stat to like lokal tori. Manny rait an tok abaut DOS tori wey e lisin to for Miramichi Riva side wel wel. Wit di hep of Lord Beaverbrook in 1947, Manny stat to dey kolet an rekod di song wey pipul wey fall big wood an pipul wey dey katch fish dey sing in Miramichi aria. Beaverbrook still hep Manny wit moni so dat e go fit arenj an du di house wey de Newcastle, New Brunswick wel. Na di house kom leta bikom di lokal librari. Beaverbrook dey mek suo sey Manny folo di kommand wey e dey give as Manny dey kolet an rekod songs an tori-dem for Miramichi aria. Beaverbrook tok sey na onli horijina song mek Manny dey kolet an rekod no bi di one wey dey no sabi how e tek kom. Wen Manny don finish di wok wey Beaverbrook give am ( Manny poblish di wok as Songs of Miramichi), E kontiniu e risach wit more freedom. Manny kom dey rekod an kolet both old an niu tradishonal song. E tok sey tradishonal song na song wey pipul dey sing from dia mind an he'd an na for dia frend to enjoi am. E stil tok sey na di pipul demsef dey form am an di muzik dey waka from one pesin wey hear am to anoda pesin. Manny no wan no weyda di muzik na old or niu tradishonal song as far as sey e song tok abaut dia kolshora bakgraund e go rekod am. E tok sey as dem dey rekod am like dat, dey don hep save di kolsho an histri of New Brunswick. E rish like twenty years (1947 to 1965) wey Manny dey play di rekod-dem for di weekli brokast on CKMR redio in Newcastle.

Manny also dey tok an rait abaut histri tins for one niuz-pepa wey dey kom out evri week. Di pat wey e dey rait e own for di niuz-pepa na "Scene from an Earlier Day". Na Manny form di Miramichi Folksong Festival in 1957.