Louis Edet

From Wikipedia

Louis Edet (Dem bon am for 1914 an e dai for 1979) bi di fest Naijá pesin wey dey di posishion of Inspekto General.E na di oga kpata-kpata for Naijá polis fom 1964-1966. Edet bi di Chairman of di Nigeria Football Assocition for somtaim for 1960. Dem bon Edet for Kalabar insaid di famili of Edet Essien an Geraldine Orok. Afta dem end di fight wey dem dey kol Nigerian civil War Edet yuz e taim to hep pipul wey sofa for di war an e leta bikom komisona for Social Services.E leta fom one chariti oganizason to tek dey hep pipul. Dem nem di headquarters of di Naijá Polis wit im nem.Dey kol am "Louis Edet House"