Jump to content

Lota Chukwu

From Wikipedia

Ugwu lotachukwu Jacinta Obianuju Amelia (Dem bon am for November 29, 1989) na Naijá Aktres wey pipul no wel wel as Lota Chukwu.shi kom dey popula afta shi akt for wan Naijá TV series Jenifa's Diary wey funke Akindele, Juliana olayode, an falz folow akt for di fim.Lota akt as "kiki" for Jenifa's Diary wey bi frend of di lid karata jenifa. Lota lik Yoga no bi smol.


 Born:  Ugwu Lotachukwu Jacinta 
           Obianuju Amelia
        November 29, 1989 (age 32)
           Nsukka, Enugu State,       
           Nigeria
Alma mater :  University of Benin
Occupation :  Actress, writer
Years active: 2014–present

Hau shi tek stat life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Lota for Nsukka,Enugu stet in Naijá, Bot na for Benin Siti e tek gro.Lota bi di last pikin of e papa, an e rid Agricultural Economics an Extenshon savice for di University of Benin an shi stil dey akt for di Royal Arts Academy for Lagos Nigeria.

Hau shi tek stat wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bifor Lota stat to akt fim e na model an shi join for di 2011 edishon of most Beautiful Girl in Nigeria shi bi Mrs Yobe state. Lota stat aktin for 2011 bot shi kom dey popula afta shi akt inside Jennifer's Diary wen shi pla di rol of kiki. Lota don akt for plenti fim dem lik The Royal Hibiscus Hotel, Falling, Fine Girl, The Arbitration, Dognapped. Lota dey for di musik video of Reminisce's "ponmile," e akt as Aramide's wey di taitu na "Why so serious". For 2011, Lota stat im fud sho wey di taitu na Lota Takes. Di fud sho dey Kari popula selebriti Kom mek fud lik Adekunle Gold, Toxin Ajibade, Aramide(Musician), MC Galaxy.

Fim wey shi do

[chenj-am | chenj-am for orijin]
YearTaituArtistRef
2017PonmileReminisce
2017Why so seriousAramide
       TV Shows
Caption text
YearTaituRolNoteRef
2015-18Jenifa's Diarykikiwit funke Akindele[16]
2015SpotlightShizawit Desmond Elliot an Segun Arinze[17]
2017Lota TakesCooking and Lifestyle show[11]
2018AjochaOofuniAn Africa magic Original[18]
2020-21EnakheJacintaAn Africa magic original[19]
     Muvee
Caption text
YearTaituRoleDaretoRef
2020When life HappensBettyOkey ifeanyi
2020Deadly instinctslidYemi morafa[Citation needed]
2020The perfect planSub lidUzodinma Okpechi
2020Wind ChasersSopotin KastUzodinma Okpechi
2020FallingCo.starNiyi Akinmolayan[22]
2020This lady called lifeOmoKayode Kasum
2019ExecutionerCynthiaWale Rasaq
2018The KinsmanNadiaDoris Ariole
2017DognappedSophiaKayode Kasum
2017Royal Hibiscus HotelSeyiIshaya Bako
2016Fine GirlLidUduak Using oguamanam
2016SpotlightLidSunkanmi Adebayo
2016The ArbitrationFaridahNiyi Akinmolayan
 Awards an Nomination
Caption text
YearEventPrizeResult
2016Scream All Youth AwardsFilm Revelation of the year (female)Nominated
2017City People Entertainment AwardsBest New Actress of the year(English)Nominated