Liz Benson

From Wikipedia

Elizabeth 'Liz' Benson (Dem bon am for April 10, 1957) na Naijá wuman wey dey akt fim, dey du tok sho an e dey dash pipul moni and propati.

How e tek stat laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Benson stat to dey sho for fim wen e bi 5 years old.E go Sylvania State College wey dey United States of America an e kolet digri way dem dey giv pipul wey dey pafom in front of plenti pipul.(Dramatic Arts).

How e tek stat work[chenj-am | chenj-am for orijin]

Benson akt for Fortunes, one drama wey dem dey sho for Television in 1993. For di sho e akt di pat of Mrs Agnes an dey sho di fim for two years on NTA Netwok.In 1994, di pat wey bi ashewo wey e akt for di home vidio Glamour Girls mek pipul no am wel wel as wuman wey fit akt fim wel wel .Benson don ritaya to dey du fim sice 1996.

As we Tek kom bak to akt fim again[chenj-am | chenj-am for orijin]

By di taim Benson go kom bak to aktin for Nollywood, e don bi bon-again Kristen an e don stat to dey tok abaut God as ful time wok. In one tok-tokb diskusion, Benson tok sey na fim wey folo Wetin e belif na im e go dey do fom nau on.

E Pasonal laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Benson bi like 25 years old, Benson fest hosband (Samuel Gabriel Erin) dai. Benson tok sey di lesin wey e lend fom e hosband giv am pawa to fit train dia pikins wen e hosband dai.

Benson wey be Efik du anoda smol kot marenj for Abuja.Di man wey e mari for 2009 na Bishop Great Ameye wey get Freedom Family Assembly an di ples wey e tek happun na di Rainbow Christian Assembly wey dey Warri for Delta Stet. Benson dey join e hosband tek manej di choch in Delta.

Film wey she dey inside[chenj-am | chenj-am for orijin]

Som fim wey Benson don dey inside wey pipul no pass bi Femi Osofisan fim wey act as Titubi one television sho wey di nem na Fortune wey shi akt as Mrs Agnes Johnson.Di sho television show for two years for NTA channel 10.Odas Naijá fim wey Liz Benson dey inside bi Evil men 1 an 2, Shame, Conspiracy, Izaga, Burden, Stolen Child, Faces, Dead End, Tycoon, Glamour Girls, Body of Vengeance an plenti odas fim.


  1. Still Falling (2021)
  2. Lotanna (2017)
  3. Children of Mud (2017)
  4. Lizard Life (2017)
  5. Hilarious Hilary (2015)
  6. Dearest Mummy (2015)
  7. Dry (2014)
  8. Toko taya (2007)
  9. Political Control (2006)
  10. Political Control 2 (2006)
  11. Political Control 3 (2006)
  12. Bridge-Stone (2005)
  13. Bridge-Stone 2 (2005)
  14. Crazy Passion (2005)
  15. Crazy Passion 2(2005)
  16. Day of Atonement (2005)
  17. Now & Forever(2005)
  18. Now & Forever 2 (2005)
  19. Squad Twenty-Three (2005)
  20. Squad Twenty-Three 2 (2005)
  21. Women in Power (2005)
  22. Women in Power 2 (2005)
  23. Inheritance (2004)
  24. Melody of Life (2004)
  25. Red Hot (2004)
  26. Turn Table (2004)
  27. Turn Table 2 (2004)
  28. World Apart (2004)
  29. World Apart 2 (2004)
  30. Èèkù-idà (2002)
  31. Èèkù-idà 2 (2002)
  32. Wisdom and Riches (2002)
  33. Wisdom and Riches 2 (2002)
  34. Dapo Junior (2000) .... Ronke
  35. Chain Reaction (1999)
  36. Diamond Ring (1998)
  37. Diamond Ring 2 (1998)
  38. Scores to Settle (1998)
  39. Witches (1998)
  40. Back to Life (1997)
  41. True Confession (1995)
  42. Glamour Girls (1994)
  43. Silenced (????)