Lionel Messi

From Wikipedia
Lionel Messi
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromArgentina, Spain, Italy Chenj-am
Country for sportArgentina Chenj-am
Nem for lokal langwejLionel Messi Chenj-am
Orijina nemLionel Andrés Messi Cuccitini Chenj-am
Fest nemLionel Chenj-am
Famili nemMessi Chenj-am
Short nameLeo Messi Chenj-am
IPA transcriptionljoˈnel anˈdɾes ˈmesi Chenj-am
Wen dem bon am24 June 1987 Chenj-am
Ples wey dem bon amRosario Chenj-am
PapaJorge Messi Chenj-am
PikinThiago Messi, Mateo Messi Roccuzzo, Ciro Messi Roccuzzo Chenj-am
RelativeMaxi Biancucchi, Emanuel Biancucchi Chenj-am
Fest langwejSpanish Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokSpanish Chenj-am
Convicted oftax fraud Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Pat of wok wey e put mindassociation football Chenj-am
Wu e dey wok forInter Miami CF Chenj-am
Post wey e deyUNICEF Goodwill Ambassador Chenj-am
Position played on team / specialityforward, midfielder Chenj-am
Wie e dey livRosario, Barcelona, Paris, Miami Chenj-am
Wen e stat wok16 October 2004 Chenj-am
Member of sports teamInter Miami CF Chenj-am
E pipulItalian Argentines Chenj-am
RilijonCatholicism Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
Footednessleft-footedness Chenj-am
Sport number10 Chenj-am
LeagueLigue 1 Chenj-am
Significant eventPanama Papers, trial of Lionel and Jorge Messi Chenj-am
Official websitehttps://messi.com Chenj-am
DefenderCristóbal Martell Pérez-Alcalde Chenj-am
Copyright status as a creatorworks protected by copyrights Chenj-am

Lionel Andrés Messi (dem bon am for June 24, 1987) wey pipul sabi as Leo Messi na Argentina futbol playa wey dey plai for Ligue 1 klub Paris Saint-Germain. Na Messi bi di kapo for Argentina Nashional tim.Messi popula wel wel as one of di best playa to eva plai futbol.E don win best playa Awod ( Ballon d'Or) for a rekod seven time. E win European Golden shoe for six time an e nem dey Ballon d'Or Dream team in 2020.Bifor 2021 wen e komot for di Klub, na Barcelona Klub e dey sins e stat to dey plai professional futbol.Wen Messi dey plai futbol for Barca, e win 35 kop for Barca. Di kop wen Messi hep Barca to win inklud 10 La Liga taitu, 7 Copa del Rey, 4 UEFA Champion Leagues.

Messi na beta playa wey sabi put goal for inside net wel wel as no bodi don pass e 474 goal wey e put for inside net for La Liga til now.Na Messi stil bi di onli playa wey put 50 goal for one sisin wey e dey plai La Liga an Champion Leagues togeda.No bodi don pass Messi 36 hat-trik wey e du for La Liga. Na Messi stil get di hiyes hat-trik for Champion Leagues (8). Na Messi stil get di hiyes assist for La Liga (192). No bodi don du assist for one sisin for La Liga pass Messi (21) an no bodi du assist rish Messi for Copa America (17).

Tori of e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na June 24, 1987 dey bon Messi for Rosario Santa Fe.Messi na di nomba three pikin of di four pikin wey e papa Jorge Messi an e mama Celia Cuccittini bon.E papa dey wok for Hiyon fatori as manija an e mama dey wok for magnet wokshop. Messi papa famili Histri get Italia pipul an Spanish pipul an e mama side na onli Itali e famili kom fom. Messi family like futbol no bi smile an e dey like plai wit e big broads Rodrigo an Matías an e kosins Maximilia an Emanuel Biancucchi. E two kosin sef lẹta bikom big playa too.Wen Messi bi four years old, e join di lokal Klub Grandoli an na Messi papa bi di kb of di Klub. Messi grama de tek am gi trainin an match e pain am wen e grama kpai wen e bi eleven years old. Dis na di risin Messi dey always luk up an point gonga go hevun wey e goal to rimemba e grama.Messi na katolik. Messi like ti sopot Newell's Old Boys an e join di Rosario Klub wen e bi 6 years old. Durin dat time, Messi score like 500 goals as a member of Rhe Machine of '87 for di Rosario Klub. Wahala stat for Messi wen e rish 10 years old.Dokto tok sey e get problem sey Messi no go fit grow like normal pikin. Na onli two years hospitu moni e papa inshurans fit pay for di tritmet wey dem dey giv Messi to mek am gro up bikos di moni rish $1,000 evri month.Newell klub fest agrie to pay di hospitu moni bot dey leta tok sey dey no go pay again.Anoda Klub River Plate like Messi wel wel bot dem too no wan pay di hospitu moni. Sins Messi famili get famili memba for Catalonia, dey kom arenj mek Messi go try e luck for Barcelona in September 2000. Di fest tim dareto Charly Rexach wan sahin Messi bot e dey fear bikos dat time e dey hard for Europe Klub no dey sahin forin playa wey neva gro up wel wel.On 14 December, Barca agrie to sahin Messi. In February 2001, Messi famili komot for Argentina kom Barcelona an dia house nia Camp Nou. Afta one year wey Messi don dey plai for Barcelona youth akademi La Masia, Messi kom upgrade so dat e nem kom enta Royal Spanish Football Federation (RFEF) in February 2002. Messi kom stat to dey plai for all kompetishion an dis mek Messi dey follow e tim mate like Cesc Fàbregas an Gerand Piqué. Afta wen e don finish e tritmet wen e dey tek to gro up wen e bi 14 years, Messi kom bi pat of di Baby Dream Team , Barcelona youth tim wet try pass for dia histrie.