Linda Williamson

From Wikipedia

Linda Williamson (e papa nem bifo shi mari na Rast, dem bon am for January 2, 1949) na one America pesin wey sabi buk wel wel abaut di tori of pipul wey dey travu for Scotland. Na shi mek plenti pipul sabi Duncan Williamson tori wel wel.

Tori abaut E Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Thomas Robinson Rast an Thelma Jane Cass bon Williamson for Madison-Wiscomson for USA. Wen shi bi six yia old,shi stodi old oyinbo tradishonal muzik dem, dey song for Kuaya dem, dey play piano stil dey play muzik wey smol grip dey play togeda. Afta shi finish skul for Yunifasiti of Wisconsin-Madison skul of muzik,shi mari one Amerika man wey e nem na Mark Headlee.Di two of dem kom dey stay for Edinburgh,Scotland so dat e hosband go stat to stodi for PhD ontop Philosophy, an shi sef kom enta to stodi one program wey konsan difren-difren tin dem(Interdisciplinary) for di Yunifasiti of Edinburgh skul of Scottish stodi dem an shi wok wit meni pipul wey Sabi buk wel-wel plus Hamish Henderson.As shi dey do di program, Williamson kpm stat to dey kolet tradishonal muzik dem, Song dem,Stori dem an (lore) som pipul molej an tradishona dem of pipul wey dey travul wel-wel for Scotland.Shi even travul wit Peter Cooke wey bi ethnomusicologist an Alan Brugord wey bi florist an shi kom intaviu an rekod Betsy Whyte of Montrose an Jare Turriff of Mintlaw, two of dem dey wok for Blair Haus.(Even sef whyte put Linda nem inside e buk wey e kol "Yellow on the Broom"). Bikos of dis pipul wey shi mit,shi kom stat to dey len abaut one man wey get seven pikin bot wey mo get waif wey e nem na Duncan Williamson an na Argyllshire pesin wey dey travul wel-wel.Afta som time shi kom mit di man for 1975. As di two of dem dey wok togeda,dem kom stat to dey love dem sef. Shi tel e hosband sey shi no wan Mari am again di man gree.Afta shi Liv E hosband, shi kom Mari Duncan on February 22,1977. Williamson stey wit Duncan for one tradishonal Scottish tent wey pipul wey dey travul dey yuz.As e dey Liv E laif,na so e put mind for wetin shi dey do.Shi rait di tins dem wey Duncan don rait e Tori buk dem wey e poblish for Edinburgh, New York, Cambridge, Oxford London an Milan. Dem two kontiniu to dey togeda on til 1993,wen dem kom sepret but Williamson kontiniu to wok wit Duncan ontop niu-niu buk dem an dem join-bodi do som Tori dem.Shi kom bak kom stey wit am for some mont dem bifor Stroke siknes kill am for November 8,2007.