Leyla McCalla

From Wikipedia

Leyla Sarah McCalla (dem bon am October 3, 1985) na Amerika muzishan wey dey sing tradishonal old muzik. McCalla bifor dey play ginta for di "Grammy-winning" band Carolina Chocolate Drops but e komot go fom e own.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na from Queen, New York City dey bon Leyla McCallas but e gro up in Maplewood, New Jersey. McCalla go Kolombia Hi Skul. E go liv for Accra, Ghana wen e bi tineja.Wen e don yuz one year for Smith Kolej, McCalla get transfa go New York Yunivasiti go rid abaut ginta paformans.In 2010, McCalla komot go liv for New Orleans an na for New Orleans e tek stat to dey yuz e skills by plarin of di strit of di French kwantas. Na from Haiti McCalla papa an mama kom from.Jocelyn McCalla wey bi e papa bi Ezekutiv Daretor of di organisashon wey dey New York Nashonal Kolishon for Haitian Right from 1988 go rish 2006. Na McCalla intaprit di ri minin of di song "Vari-Colored Song" for e habom.McCalla mama na Régine Dupuy wey kom New York wen e stil bi 5 years.Régina Dupuy papa wey bi Ben Dupuy get one Niuz Pepa kol Haïti Progrès an na New York dey Niuz Pepa dey but e dey tok abaut tins wey pipul get an du.McCalla mama fom Dwa Fanm organisashon.Dwa Fanm na organisashon wey dey fight for wuman wey dia hosband dey bit.McCalla yonga sista na Muzishan wey dey stey New Orleans.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

McCalla na memba of di Carolina Chocolate Drops from 2011 go rish 2013.As of 2019, e don enta anoda grup wey di nem na Our Native Daughters As of 2017, McCalla dey sing araund wit e New Orleans grup wey bi online three memba. One of di memba na e hosband Daniel Tremblay wey sabi ginta, banjo an Iron griangu an di oda pesin na Free Feral wey dey sing an sabi ginta. For 2019-2020, McCalla sing for meni ples an di pipul wey e kari join bodi na Dave Hammer wey sabi Eletrik ginta, Shawn Myers wey sabi bit drum, an Peter Olynciw wey sabi Eletrik bass.

E fest habom[chenj-am | chenj-am for orijin]

McCalla fest habom wey bi Vari-Colored Songs sel wel wel an pipul like di habom. Vari-Colored Songs habom wey McCalla du na to sho respet to Langston Hughes bikos meni of Langston Hughes puem , Langston Hughes tradishonal tori wey e sing wit Haitian Pidgin. McCalla tok sey e fest habom na Heart of Gold bikos di habom tok wetin de di mind of Hughes.