Leda Valladares

From Wikipedia

Leda Valladares ( dey bon am on December 21, 1919 an e kpai July 13, 2012) na Argentina singa, song-raita, pesin wey rid muzik an pesin way dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way. Dey bon Leda Valladares in San Miguel de Tucumán in Norta Argentina. Valladares gro up lisinin to old European muzik an tradishonal song of Amerindian pipul wey dey live for di aria. Wen Valladares dey smol, e len how to play Piano. Valladares wit e broda form one muzikal grup wey dey pratis tradishonal song, jazz an kul muzik or blues. Valladares dey poblish puem til e kpai. E fest stat e yunivasiti stodis in Nashonal Yunivasiti of Tucumán wen e rid Inglish, Valladares Afta one year chenj klass to filosofi an edukeshon. In 1948, e finish yunivasiti. As Valladares dey rid filosofi an edukeshon for skul, e stil chuk eye for muzik stodis in Akedemi of Fine Art an in Indipendet risach among pipul wey dey sing tradishonal muzik. Afta wey Valladares finish skul, e fest tish for somtime bifor e pak go Paris in di heli 1950s. For Paris, e form one muzik grup wit Maria Elena Walsh. Both of dem dey sing tradishonal Argentina song for wey pipul dey drink an for tihata. Di grup go bak to Argentina Afta Juan Peron komot as presidor bikos of Libiretin Revolushon wey happun in 1956. For dat time, pipul kom like Argentina tradishonal muzik smol an Valladares grup dwy mek albom an sing dat time. Pipul wey kom dey lisin an enjoi dia muzik no plenty like dat. Valladares an e sekod wey form di grup Maria Elena Walsh kom skata an go dia way in 1962. Valladares kom stat to dey kolet an rekod di tradishonal old song of Argentina. E mek some albom from di koleshon an rikodin wey e du from 1960 go rish 1974. Di nem of di albom na: Mapa musical de la Argentina (Musical Map of Argentina). Di albom rikod an kip meni old tradishonal song wey dey di kontri from Doreen difren lokeshon.