Leadway

From Wikipedia

Leadway Assurance Company na wetin pipu stil no as Leadway. Na insurance kompini wey dia headofis dey for Lagos for insaid Naija. E folo for some of di big-big insurance kompini for Naija. Leadway dey give insurance for kompini, for di one wey pesin wan do for imsef and for wen anytaime wey bad tin happun for who wan travel and even laif insurance.

How e tek stat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Sir Hassan O. Odukale stat am for 1970. E fest stat as bizness for 1971 and e stat as dairekt insurance for moto. E kom big rish other saide of plenti biznes until e come get plenti-plnti insurance kompini dem wey dey unda am. Di kompini moni kom big wella as time dey go and now dem dey wok wit big-big kompini like oil and gas or kompini wey dey produce tins. Estill dey reduce moni mata for kompini wey dey into moni tins like Bond, Secure credit and other yawa wey fit gas wey kompini no fit espekt lyk wen moni los or if dem no handul kompini well. Na Tunde Hassan-Odukale be di oga pata-pata for di kompini now.