Lata Tondon
Lata Tondon na India kuk wey kom from Madhya Pradesh. Dem bon ha fo April 15,1980, for September 2019, na shi kolet di wod rekod fo Guinness ontop sey shi kontiniu tu kuk for 87 hawas, 45 minits.
How shi Tek Stat
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Lata Tondon for 15 April 1980 fo north-easthern pat fo Rewawey bi Madhya Pradesh stet fo India. Shi stat tu dey kuk wen shi still dey yong an na ha granpapa inspaya ha. Akodin tu wetin dey di Hindustan Times, shi praise ha mama an ha moda-inlaw sey na dem tish ha how tu kuk an shi tok sey, na dem mek ha tu be beta kuk. Lata kom go stodi fo skul of kuk wey dey fo London fo di United Kingdom, an shi wok wit French kuk wey bi chef Cloud Bosi an chef Career Jun Tanaka wey bi kuk fo American British television.
Ha Karia
[chenj-am | chenj-am for orijin]Fo 2018,na shi bi di winna fo intanashona India kuk fo di year. Fo 2019, shi kom set di rekod fo marathon cooking World Guinness .Na shi bi di fest wuman fo di wold tu get di rekod, an na shi still bi di fest wuman wey bi kuk wey enta di Guiness World Record Book. Shi kuk fo 87 hawas 45 minits wey shi no stop na e mek ha set di rekod.
Shi don wok fo India an London wie shi stodi. Lata Tondon na still spika shi bi fo TEDx. Shi don fokos tu promot di rigional cuisine of India, shi don trai tu espand di flavor an style dem fo di wey dem mek di food dem. An shi don evin trai do mek beta way tu dey eet an mek eni food no dey waste wen dem dey kuk.
Honor Wey Shi Don Risiv Dem
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dey don honor Lata Tondon wit difrent difrent awod dem wey show how di Asia Book of Records dem tek rekognaiz ha, awod dem wey bi;
India Book of Records
Indo-China Book of Records
Vietnam Book of Records
Laos Book of Records
Nepal Book of Records among di odas dem.