Lai Mohammed

From Wikipedia

Layiwola Lai Mohammed (Dem bon am December 6, 1951) na Naijá lorya an politishian. Im bi di Minista for informashon an kolture, im don dey di ples sice November 2015.Lai Muhammad stil bi di forma All Progressives Congress National Publicity Secretary.

Tori abaut Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dey bon Lai Muhammed inside Alhaji Mohammed Adekeye famili. E kom fom Oro for Kwara Stet.E rid French for Obafemi Awolowo University wey e tek get e Bachelor Degree in di year 1975.Lai Muhammed rid Law for University of Lagos kon leta go Nigeria Law School in 1986. As lorya wey dey wok, e folo stat di Legal Firm of Edu & Mohammed for 1989.

Bizness[chenj-am | chenj-am for orijin]

Lai Mohammed na biznesman an na e bi di chairman for Opmedia Limited, wey bi pat of Afromedia Plc wey don dey sice 18 December 2008. Na im bi di Dareto for Afromedia Plc sice May 2011. Lai Mohammed na memba of Nigeria Institute of Public Relations (NIPR) an e wok as pesin wey dey folo pipul tok as ofisa for 10 years wit di Naijá Airpot, wey kon bi Federal Airport Authority of Nigeria (FAAN).

Politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

For October 2002, na Alhaji Lai Mohammed bi di pesin wey stand as Kwara State govnor 2023 for Alliance for Democracy parti. Lai Mohammed don sarf as Chief of staff for Tinubu wen im bi di govnor.

Lai mohammed na politishian an forma National Publicity Secretary for All progressives Congress (APC) for Naijà. Na November 11, 2015, im enta ofis as minista for infomashon an kolture onda President Mohammed Buhari govment for Naijá, afta Naijà Senate don chek am. Lai Mohammed stil enta ofis di sekond tim for 21 August 2019.