Konga.com

From Wikipedia

Konga.com parti na Naija E commerce kompani wey Dem opun for July 2012 an dia headquarter dey for Gbagada, Lagos State. Dem dey offer tod parti online market ples an fess parti dairekt retail spanning wit difren difren katigori wey get buyer elektronic, fashion, home propati, books, smol pikin propati,komputa, phones, tablet an tins wey we dey yuz for gadjet, an Dem olso dey giv health care an pasonal care prodot. Di kompani dey olso get logistics savis(EXPRESS) wey dey quickly du diliva goods for costoma.

How e tek stat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem stat Kongo forJuly 2012 an na Sim shagaya, wit 20 staff. Dat time na only for Lagos State dem dey wok an na only baby tins,beauty pasonal care katigori dem dey operate wit but leta leta dem Kon dey operate for oll oda State inside Naija for Desemba 2012. Di fass chenj fit bi bikos of anoda online kompani wey dey du di tin wey dem dey du too wey dem dey kol Jumia.

For 2013 don get $10 million Seria A fom investment AV kinnev an Naspers. Q2 2013, Konga beta tess "Konga mail", wey kom mek Dem opun tod parti ritela dis kom mek Dem dey muv away fom fess parti online ritela model.