Kloka Anna

From Wikipedia
Kloka Anna
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromSweden Chenj-am
Wen dem bon am15 July 1797 Chenj-am
Wen e kpai1860 Chenj-am
Wok wey e dey ducunning folk Chenj-am

Anna Johansdotter or Anna Jonsdotter (dey bon am July 15, 1797 an e kpai in 1860) na Sweden tradishonal nativ doktor an wuman wey get pawa to tok wit spirit. Meni old old tori tok abaut Dis wuman. E dey popular wit e nik-nem Kloka Anna ("Wise Anna").

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Liatorp wey dey Småland dey bon Anna on July 15, 1822. Anna dey wok for farm onti 1822 wen e kom stat to dey tekia of e sef as Native tradishonal doktor. Anna fest stey in Göteryd from 1822 go rish 1840s an afta dat e pak go Pjätteryd. Na for Pjätteryd e tek de popular wel wel. Akordin to old tori, Anna stat to get sens to du native doktor afta e don chop some cowberry wen white snake don torch wen Anna dey bush wen e stil bi smol pikin. Pipul sabi Anna as pesin wey fit yuz e mind to no wetin dey di sik pesin an e fit mek dem wel. Dis e habiliti mek pipul for di kontri to kom mit am wit dia sik pipul. Anna no get fix prize for di moni e dey kolet for tritmet but e go luk how di poket of di pesin bi bifor e go tok how much moni e wan kolet. Dis one mek am dey du free free tritmet meni times bikos some pipul no get moni at all. Pipul tok sey Anna na native doktor wey get blak eyes an wey get vois wey deep an sey e get meni blak cat. Anna dey yuz meni plant root to tekia of sik pipul. Anna pikin Kristina wey bi gel dey join hand wen Anna wan go find medisine an wen e dey trit sik pipul. As e sabi rid pesin mind, pipul dey kom mit Anna wen somtin lost so dat e go fit tel dem how to no how di tin tek waka.