Kirin Narayan

From Wikipedia

Kirin Narayan (dem bon am for November 1959) na Amerika pesin but wey e granpapa-dem kom from Indian. E na pesin wey dey stodi human koshor an e dey rait abaut tradishonal tori.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kirin Narayan na di pikin of Ramji Contractor wey kom from Nashik an e mama na Didi Kinzinger wey bi Amerika but Did Kinzinger grapapa-dem kom from German. Narayan papa na Enjiniha an e mama na pesin wey dey draw house buildin for pipul. Dey bon Narayan for Bombay an e go skul for Indian bifor e famili kom United States in 1976. Narayan go [[Sarah Lawrence College] ]wie e tek get BA satifiket in raitin. Narayan kom go Yunivasiti of Kalifoniha, Berkeley go du e Ph.D in 1987. E na leshura wey dey tish "Anthropology" an "South Asian Studies" at di Yunivasiti of Wisconsin-Madison. In 1993, Narayan kolet one awod wey di nem na Guggenheim Fellow for di aria of anthropology an kolshura stodies. E na professor in di Kolej of Asia an di Pacific at di Australian Nashonal Yunivasiti

Buk wey e rait[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Narayan rait di buk "Storytellers, Saints, and Scoundrels: Folk Narrative in Hindu Religious Teaching". Di buk kolet di Victor Turner Prize from di "Society for Humanistic Anthropology" an di buk an anoda buk wey anoda pesin rait kolet di "Elsie Clews Prize" for Folklore from di Amerika Folklore Sosaheti.

In 1994, Narayan poblish e novel Love, Stars and All That". One raita wey bi Indian raita an editor Dom Moraes praise di wok an e tok sey:

"Dis novel na koret an fine buk. Narayan yuz sens rait di buk, an e tok for di buk wetin e bi like to bi Indian pesin wey dey bon for Amerika. Pesin wey rid di buk go si sey Narayan na speshal raita, an sey e bi like sey na from hevun Narayan tek kari di gift of rai tin kom. E stil tok sey Narayan get beta future for raitin buk."

Narayan poblish anoda buk Mondays on the Dark Night of the Moon: Himalayan Foothill Folktales in 1997. For 2002, na Narayan rait di introdoshon pat of di niu edishon of di fest koleshon of Indian tori in Inglish, Mary Frere's old Deccan Days. In 2007, Narayan rait