Kenny Blaq

From Wikipedia

Otolorin Kehinde Peter ( dey bon am 30 September 1992) wey pipo sabi wel wel as Kenny Blaq na Naija komedian an singa. Kenny Blaq paform for di 2nd edishon of Unlock Naija Independence Selibrashon, an at di final of Afrika Majik Owambe.

Tori of e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na 30 September 1992 dey bon Kenny Blaq. E do e pamari an sekondri edukeshon in Ejigbo Legos. Bikos sey Kenny Blaq peret no get moni for skul fees, e go do lesin to fit rait e WASSCE.

Afta Kenny Blaq don do smol work for SMA FM, e go get trenin as a host an redio presenta for "Fedira Redio Korporashon of Nigeria" (FRCN) for dia skul wey de Legos. SMA FM na one redio steshon wey de insie kolej.

How e tek work[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 1998 Kenny Blaq start to dey do komedi. E don do komedi for big big komedi show like inside an outside Naija. Some of di komedi show wey e don paform na: I laff with McAbbey, Gbenga Abeyinka Laff mattaz, Ali Baba (January 1st Concert & Fina-Ali, Cool FM Praise JAM, Darey Love Like A Movie, AY AY LIVE, BasketMouth Lord of the ribs, Africa Laughs in Uganda, SEKA Live in Rwanda, ECOFEST in Sierra Leone, an BENIN GLO LAFFTA FEST in Nigeria.

Kenny Blaq get e own komedi show wey e nem "Oxymoron of Kennyblaq". Dis e own show win Best Komedi show in 2017 an 2018 for di awod wey Naija 102.3 arenj. Na onli three years Kenny blaq show last an e win best komedi show for 2 year out of di three year.

Di fest time wey Kenny Blaq nem wan hapiya for intanashonal niuz na on di 30 September 2018. Na for one komedi show wey e do for Indigo 02 wey di tahitu na "Kenny Blaq 'State of Mind". Na SMADE kari am go UK bikos na dia dia kompini base. Dis show kom mek pipo dey see Kenny Blaq as one of di komedian wey get levu for Naija.

Kenny Blaq State of mind opun door for am wel wel as dis one mek am paform for Indada X; The Laughing Leopard Comedy event. E nem still show for Royal Festival Hall. Wen di list of 100 youth wey get mouth wan kom out in 2018, Kenny Blaq nem de di list. Di risin e nem enta di list na bikos na im win "The Future Award Africa" Prize for komedi in 2017.

In 2020, Kenny Blaq risiv di Ooni Youth Royal Award.Wen di list of 100 youth wey get mouth wan kom out in 2018, Kenny Blaq nem de di list. Di risin e nem enta di list na bikos na im win "The Future Award Africa" Prize for komedi in 2017.