Jump to content

Kema Chikwe

From Wikipedia
Kema Chikwe
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am14 September 1951 Chenj-am
Ples wey dem bon amAba Chenj-am
PikinNaeto C Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deyMinister of Aviation of Nigeria, Ambassador of Nigeria to Ireland, Minister of Transportation Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Nigeria Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am

Kemafo Nonyerem "Kema" Chikwe na di Naija forma Federal minister of Aviation. Na shi bi di Nashonal wuman leader of Naija politika parti of di People's Democratic Parti (PDP).

Chikwe stat skul wen shi dey five years old foir Aba wey kon bi Abia nau. Na French shi go stodi for Advanced Teachers, College, Owerri. Shi kon go Queens College of di City Universiti of New York wia shi get digre in French. Shi get doctorate fom di Universiti of Nigeria, Nsukka, insaid curriculum edukeshon.

Chikwe don wok as redio presenta, editor an poblisha,. Na shi bi di Chief Executive an poblisha of Prime Time Limited wey dey du Ash Magazine. Shi don du theree buks, don folo pipu rait buk an don hep plenti du wetin dem rait wel.

Shi fest enta politis in sekond repoblik. Di politika parti shi get koneshon wit na Nashonal Party of Nigeria, NPN, bifor Shi kon go NRC, UNC an nau PDP. Na Shi bi minista of Transport onda, an leta Aviation by President Olusegun Obasanjo, Shi dey ofis rish May 2003. Shi don trai bi di Govnor of Imo Stet. In 2009, na shi bi di Nigerian ambassador to Ireland.

One of im pikin Naetochukwu Chikwe wey plenti sabi as Naeto C na im pikin.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]