Katung Aduwak

From Wikipedia

Katung Aduwak (dem bon am for Mash 21,1980) Na im bi di winna of di premier edishon of di Big Brother Nigeria realiti TV show bitwin Mash 5 an Jun 4, 2006. He bi native of zonkwa Kaduna state, Nigeria an he bi scriprita ,produsa an daireto as wel as graduate of political science. He bi one time media panelist for Harvard Africa Business skul forum an served for meni years as senior channel managa for MTV Base,Senior creative Director for VIACOM intanashonal an Executive Director for chocolate city. As e bi now na im bi di CEO of one O Eight media an African partna for campfire media.

How He Tek Stat Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Big Brother Nigeria[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dis 26year old Aduwak na im win do event wey Michelle Dede an Olisa Adibua host. Na do veri fes seasin for jun 4,2006 e get tek home prize of $100,000, 11 years lata he tok say di key to succíd for di show na for am to bi imself an strategi.

After Big Brother Nigeria[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta di reality Tv show Aduwak muv go New York go foda im edukashom for di Digital film Academy, graduate wit dairetorial digrí an kom enta filmmaking.

Filmmaking[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wetin suppose bi Aduwak debut fim na Heaven's Hell. Di main date to riliasi di fim suppose bi januari 23, 2015. Dem no fit riliasi di movie until May 10, 2019. Di movie clips d do am for 2012 by one O Eight media, dem partna wit BGL an Hash teg media House an starred Nollywood akto dem an aktress an Nigeria singa wake. For 2020 Aduwak dairet one shot fim wey expose di conflict betwin African American dem an di African wey dem abroad wey di taitu na "Not supposed to bi Here" Aduwak mari wan Raven Taylor Aduwak an e get one boi pikin.

Fim Wey He Du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Movie[chenj-am | chenj-am for orijin]

Edit Unwanted Guest (2011) PUNEET!TV (2012) When Love Happens (2014)[13] Heaven's Hell (2019) Not Supposed to Be Here (2020)

Muzik[chenj-am | chenj-am for orijin]

Superstar" - by Ice Prince (2011)