Kati Zsigóné

From Wikipedia

Kati Zsigóné (Józsefné Zsigó, bon Julianna) ( dey bon am June 16, 1953 in Kecskemét) na Hungarian wuman wey bi aktist, an painta. In 2009, e nem de among di five best painta in di wold an di nomba one for Europe kontinet.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Juliana papa na farma an e dey yuz hand mek basket. E papa give an one nik-nem "Kati". Wen Kati bi three years old, e peret marej skata bikos e papa dey bit e mama an sey e papa too dey shank ogogoro. Kati kom stey wit e mama even sey e mama na poor wuman. Na onli Kati e mama bon. Bikos di smol moni wey Kati mama dey kolet as klina as e dey klin for di lokal katolik skul no go rish dem, Kati stat to dey wok wen erish 14 years. Kati mari József Zsigó on May 7, 1977. Di marej produs one gel pikin Katalin wey dey bon on July 9, 1978. Kati see e grapikin Panna wey bi gel on January 3, 2013.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pipul sabi Kati sey e no how to paint bikos of di sopot wey e hosband give am. Kati tok sey e hosband na e nomba one soporta an fans. Na wen Kati bon e gel pikin an bikos e wan mek paint di room wey e pikin wan dey, dis one mek am stat to paint. For dat time, e hosband advais am sey mek e no go hiya eni painta but mek e paint di room by e sef. Kati kom stat to dey len how to draw an kolor wel wel. Kati pratis eight difren mentod of paintin an kolorin but na wall paintin e sabi pass. Afta Kati don len wall paintin, e stat to du tile paintin, orye paintin paintin ( di one na to draw horse or Hungarian lokal hanimal, how some aria bi an emeji), seiling. E stil len how to put disain for kup an plate, tebu klot an best. Kati stil len anoda paintin mentod wey di nem na "riseliözés".