Katherine Mary Briggs

From Wikipedia

Katharine Mary Briggs (8 November 1889 - 15 October 1980)na one British Folklorist an raita,wey rait The Anatomy of Puck, di four folum Dikshonari of British Folk-Tales inside Inglish Langwej,an Meni oda buk dem on top Fairies an Folklore. From 1969-1972, na shi bi di president of di Folklore Sosaiti, wey yuz im nem tek establish one awod tek commemorate Im life an wok.

Baografi[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Katharine Briggs for Hampstead,London.Na shi old pas for di three girl pikin dem wey Ernest Edward Briggs bon an im kom from Yorkshire (Im famili do wel an get plenti moni for di mining wok wey dem do for Halifax an for Wakefield), an Marry Cooper.Im oda two sista dem nem bi Winifred an Elspeth Ernest biWater hiColor artist wey get speshal i upnt noerest for 'it'Scottish sceneryan Im dey always tell Im pikin difren difren stori an e bi like sey na dis stori dem kom mek Katharine get lon time intres.Di famili kom muv go Perthshire for 1911,Wie Ernest biud one haus ,Dalbeathiehaus. Ernest dai for die afta two yias for 1913.Katharine bigin to dry go Lady Margret Hall,Oxford for 1918, an shi kolet B.A for 1922 an stil kolet Im M.A for 1926.Katharine kom go back to dia ples (bikos of di famili coal legacy, an one Collieryfor Normantaun,shi no nid to dey find wok),shi jus bigin todey rait an dey do play dem- Al Im famili dey enjoi di tiata produshon dem, an na wetin Katharine want for im life bi dat- an shi stodi folklore an 17th- senturi Inglish Histri. Shi gain im Ph.D wit one thesis on top folklore inside Seventeenth senturi litresho(Folklore in Jacobean litresho) afta di sekon wold war; during di war, shi don dey don tish for one Polish Skul an wen shi wok for di medika bransh of di WAAF. Briggs kom bikom pesin wey pipul know Wel- wel as Folklorist.Afta Im first buk on top Fairies,The Personnel of fairyland,shi kontiniu to rait Meni oda buk dem on top fairies an folklore inkludin The Anatomy of Puck an It's Sequel,Pale He ate's Team(1962). An Encyclopedia of fairies(1976);an shi even rait Meni buk dem for smol- smol pikin dem like The Legend of Maiden-Hair(di first buk wey shi poblish)or Hobberding Dick, an Kate Crackernuts. A Dictionary of British Folk-Tales for Inglish Langwej: Part A:Folk Narratives(1970) wey shi ripobish for three volume for 2011 as Folk Tales of Britain,an Phillip Pullman tok abaut am wen e dey do di introdoshon sey na di koleshon ful pas an naim get otoriti pas for British folktaleswey dem don do. For 1969,dem giv am Doktorat awod for Litresho an kom mek pdi president of Folklore Sosaiti.Shi dey do post of president on til 1972, an dem tek Im nem tek dash one awod wey dem go dey giv pipul.