Kaffy

From Wikipedia

Kafayat Oluwatoyin Shafau (dem bon am for June 30, 1980) wey pipul sabi wel wel as Kaffy na Naija dansa,, choreographer, dans instructor an fitness koch. Na Kaffy bi di fonda an hona of Imagneto Dance Company. One tin wey dem tek no am wel bi sey shi na di Guinness World Record for di "Longest Dance Party" for di Nokia Silverbird Danceathon for 2006 wey shi an her dans team break.

How shi Stat life an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Kaffy an e gro up for Naijá. Shi go Chrisland Skul Openings, for im primari skul, Opebi an Coker Secondary School Orile-Iganmu, for im sekondiri Skul. Kaffy go Yaba College of Technology'k , shi rid Data Processing and Computer Science fom Olabisi Onabanjo University.Kaffy for like bi Aeronautic Engineer

How e tek stat wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kaffy's dansin Karia stat wen shi go one event to pafom onstage for somebodi wey spot ha when shi dey go National Stadium for weekends for dans pratis an wokouts. For 2006, Kaffy lid ha dans grop to break di Guinness Book of Record for "Longest Dance Party" after dey dans for 55 hour an 40 minute.Kaffy bi dans instructor wey divelop innovative visualisation-based methods to tich dans and dans fitness for accelerated-learning format. For 2017, shi create 'The Dance Workshop ' na dans convenshion wey di aim na to train an mentor professional dansa an promote kultural exchange inside di Nigerian dance industry. Di 2017 Edition feature America's lidin choreographer, AY Hollywood.

E Pasona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kaffy mari Joseph Ameh, wey bi music dareto and drumma for Naijá singa P-Square.Kaffy don bon two pikin.