Juliana Olayode

From Wikipedia

Juliana Oluwatobiloba Olayode (Dem bon am June 7, 1995) wey pipul no wel wel as Toyo Baby na Naijá Aktres, poblik Spika wey dey tok abaut sex bifor marenj among youth. Di nicknem Toyo Baby na di alias fom di TV seriesJenifa's Diary wen e akt as Toyosi inside di TV series.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Juliana inside di famili of eight an na Lagos e tek gro up. Juliana kom fom Ipokia lokal gofment of Ogun Stet. As shi dey gro up, shi no nó sey shi go bikom aktress as shi tek sabi akt rich.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bifor Juliana bikom popula, shi don akt inside four fim like "Couple of Days" wie shi pla di rol of "Judith". Shi kolet di rol for Jenifa's Diary afta shi du wel for di ordishion. Na Jenifa's series TV mek am popula for Naijá Nollywood fim Indostri. Olayode na pesin wey no like to sho e self even as shi popula.

Buk wey e rait about imself[chenj-am | chenj-am for orijin]

For di sekond half of 2017, Juliana wait one buk abaut imself. Di nem of di buk na Rebirth: From Grass to Grace. For di buk, Juliana tok abaut e pasona life, Sexual Abuse an Karia.

Fim wey shi dey[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Jenifa's Diary
  • Where Does Beauty Go
  • Rivers Between
  • Couple of Days
  • Life of disaster
  • Move on
  • Bridezilia
  • The Cokers