Juan Tomad

From Wikipedia

Juan Tamad ( for Fillipi langwej, e mins "Lazy John") na one karata wey de inside Fillipi pipo tradishonal tori an di karata dey lezi. Di tori dey always show am as smol pikin, but for odas tori-dem, e na young man.

Di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Juan Tamad tori na one tori wey tok abaut how e lezi sotey e mumu join am an di tori leta kom bi komedi. For di tori, Juan Tamad si one guava tree wey e fruit don ripe wel wel. Bikos e too lezi to klimb di tree an get di ripe guava, Juan Tamad kom slip onda di tree kom dey wait mek di guava fall down by itself. E opun e mouth so dat as di guava dey fall, e go Jos enta e month daret. Odas Juan Tamad tori wey de na:

  • Juan Tomad an di Crabs

Juan Tomad mama tel am sey mek e go buy crab for maket. Bikos e dey lezi to kari di crab go home, Juan Tomad rilis di crab inside one gota kom sey mek dem dey go home as e go dey folo dem for back.

  • Juan Tamad an di Rice Cakes.

Juan Tamad mama mek some rice cake an e tel am sey mek e go maket go sell am. Wen Juan Tamad dey pass near one small riva, e si some frog dey play inside wota. Bikos e dey lezi, JuanTamad trowa di cake give di frog. Wen e reach home, Juan Tomad tell e mama sey di pipo wey buy all di cake neva give am money. Juan Tomad tell e mama sey na next wik dem go bring di moni.