Joyce Kalu
| Man abi wuman | wuman |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Wen dem bon am | 25 September 1970 |
| Ples wey dem bon am | Abia State, Ohafia |
| Fest langwej | Igbo langwej |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Igbo langwej, Naijá langwej |
| Ancestor place | Ohafia |
| Wok wey e dey du | actor, film producer, film director |
| Pat of wok wey e put mind | acting |
| Wie e go skul | University of Port Harcourt, Lagos State University |
| Academic degree | Bachelor of Arts |
| Wie e dey liv | Naija |
| E pipul | Igbo pipul |
| Awod wey e kolet | City People Entertainment Awards, Nollywood Movies Awards |
Joyce Kalu (dem bon am September 25, 1970) na Naija aktres, Fim podusa an dareto for di Naija Fim indostri.
Awods
[chenj-am | chenj-am for orijin]Best Actress in Nigeria, Best Actress in a Leading Role, Most Promising Act, and Most Prominent Actre in Nigeria.
How Shi Tek Stat Life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Joyce Kalu dem bon am September 25, 1970 for Ohafia Abia Stet, south Eastern Naijá. Na shi bi di last gel of nine pikin dem, shi don mari wit three pikin dem.
Skul Wey Shi Go
[chenj-am | chenj-am for orijin]Kalu du primari an Sekondari edukashon for Abia Stet, Naijá. Shi stil get e Bachelors digri for Marketing fom Lagos State University (LASU).E no end here O!! Shi Kom stil go get diploma in komputa science.
How Shi Tek Stat Wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Joyce Kalu stat ha aktin karia for 2005.Shi Kom dey popula afta shi appear for Wan Nollywood Movie "Take me Home". Shi bi biznes wuman sef ooo. For 2018 Joyce Kalu appear for Wan muvi wit Rita Dominic, Enyinna Nwigwe an oda Nollywood akto dem for di award winning muvi wey di tiatu na "Bound" wey di producer na Lilian Afegbi. Di muvi Bound win Africa Magic viewers Choice Awards (AMVCA) 2018 for Best indigenous langwej(lgbo). Base on ha involvement for Nigerian film industry, Communiti an Chariti Oganizashon dem, dem Kom honor ha wit Chieftaincy tiatu of Apunawu1 of Ohafia Community, Abia state wey His Royal Paramount Ezieogo, Prof U.I.E Image wit di entire Ohafia monarchy. Dem giv am dis Chieftaincy tiatu for Januari 1, 2016. Joyce Kalu kolect honorary award from Niger Delta Icon an Dynamic Award (NDID) as di most influential Ktres of di year (2020)
Fim Wey Shi Du
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Take me Home (2007)
- Obianama (2018)[5]
- Oderi gwugwu(2018)[5]
- Isioma Scotland (2018)[5]
- Bound (2018)[6]