Jomoke Odetola

From Wikipedia

Jomuke Odetola (Dem bon am for October 16, 1983) na Naijá aktres wey stat e Nollywood karia for Inglish langwej sinima , bifo shi go dey akt for plenti Yoruba langwej fim dem.

How e tek stat life an Skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am for 16th October 1983 for Lagos.Olajumoke odetola na shi bi last bon of im papa and mama of 9 pikin dem(6 girl pikin an 1 na man pikin) Di aktres na from ijemo for Abeokuta Ogun State, odetola go ABATI Nur/Pry Skul for Lagos State. Shi kom go im skondari Skul for Abeokuta Grammar School "ABEOKUTA Girls Grammar School Abeokuta" Shi mek im fest digri from Ajayi Crowther university, Oyo state. Shi mek im bachelor's digri for infomashon an kommunikashon Teknologi/komputa science, shi muv go federal university of Agriculture Abeokuta, shi graduate wit Master digri for komputa science. Shi opun up for one intaview sey shi graduate from di higher institushon wit CGPA of 4.3 Jumoke do im NYSC savice year for Abia State.

How Shi Tek Stat Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akordin to Punch intaview Odetola mek am opun sey e papa an mama no fest like am as e wan bi aktres bot wen dey see am sey e no wan chenj e mind, e paret liv am.Shi folo tok abaut kariata for di film "Somewhere in the Dark" for di film dem wry akto like Gabriel Afolayan wey shi sí as most challegin film rol dey inside.Otedola like Majid Michel an Omotola jalade Ekehinde as e padi dem for di aktin an Abiodun jumoh na ha main mento for di fim biznes.

Wahala wey Shi Fes[chenj-am | chenj-am for orijin]

Jumoke life no dey free fom wahala, shi fes one wahala wen one wuman for UK tok akordin to di tori wey dem Gistlovers sey e slip wit ha husband wey pipu sabi as Viola Majekodunmi even wen di aktres no sey di man don mari.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2015, shi win revelashon of di year kategori of BON Awod dem. An for di Africa Magic Viewers Choice Awards, Odetola win di awod of best indigenous lankwej fim for ha rol fo Binta Ofege an Somewhere In The Dark. Odetola stil win di awod for di 5th edishon of di sirimoni tru Somewhere in the Dark.Shi also win di best aktres for lidin rol (Yoruba l) for 2017 Best of Nollywood Awards in Ogun State. Di 2017 City People Movie Awards see Odetola get nominashon for best suportin actress (Yoruba). Jumoke Odetola kom be di Best Aktres

for di City People Movie Awards, 2018.

Fim wey Shi Akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Somewhere in the Dark
  • Glitterati
  • Binta Ofege
  • Heroes and Zeros
  • Lagido
  • Bachelor's Eve
  • Alakiti
  • HigiHaga
  • Tinsel
  • The Return Of HigiHaga
  • Family Ties
  • Kanipe (2017)
  • Wetin Women Want (2018)

Awards an nominashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Caption text
Year Award Category Fim Result Ref
2019 Best of Nollywood Awards Best kiss in A movie Agbokolori Nominated
2019 Best of Nollywood Awards Best Actress in a lead role Yoruba Agbokolori Nominated [16]