Joint Admissions and Matriculation Board

From Wikipedia
Joint Admissions and Matriculation Board
committee
Inception1978 Chenj-am
KontriNaija Chenj-am

Di Joint Admishon an Matrikulashon Board (JAMB) na one organasashon for Naija wey dey set ezam kweshon for pipo wey wan enta hi-ya institushon. Na JAMB dey set di UTME ( Yunified Tertihari Mayrikulashon Ezaminashon) ezam for onda graduate wey wan enta Nigeria Yunivasiti.

Na JAMB stil dey set ezam for pipo wey wan enta politeknik, an kolej of edukeshon. All di pipo wey wan rait UTME go don rait WASSCE (West Afrika Sinior Skul Livin Satifiket) wey WAEC ( West Afrika Ezaminashon Kansu) or NECO ( Nashonal Ezaminashon Kansu) Di fest oga patapata for JAMB na Michael Saidu Angulu wey bi dia oga patapata from 1978 go rush 1986. For todey, dia oga patapata for JAMB na Ishaq Oloyede. Forma presidor Muhammadu Buhari chuz am in August 2016. For 2023, JAMB tok sey dey go do dia ezam on 14 January 2023 an e go klose on 14 February 2023.

CBT Senta[chenj-am | chenj-am for orijin]

JAMB CBT senta na difren difren aria an lokashon inside Naija wey pesin fit rejista to do di UTME. Na evri stet for Naija get wie pipo fit regista to rait di ezam. FCT Abuja sef get JAMB senta.

Di ezam[chenj-am | chenj-am for orijin]

Evri year, JAMB dey set ezam for pipo wey wan enta Hi-ya institushon. For 2022, na ova 1.7 million pipo rejistato rait UTME ezam. If pesin no enta Hi-ya institushon for di year wey e rait di ezam, e no go fit yuz fi sem risot enta di skul next year. Di pesin go nid to sit an rait anoda UTME ezam bi dat. Di risot wey smol pass wey pesin fit get for UTME na zero an di score wey hi pass wey pesin fit get na 400. Di ezam dey test how pesin ondastandin rish, how pesin fit kwik kwik tink, an how pesin fit get koret ansa fast fast. Pesin go yuz 2 hours tek do di 180 kweshon wey dey di UTME ezam kweshon pepa. Na onli English lanwej evri bodi go do, di oda pepa-dem dipen of wetin di pesin wan go rid for skul.

Wen di pipo don rait di ezam finish, JAMB go kom sit down tink about di mark wey pesin go get bifor e go fit enta Yunivasiti, Politeknik, Kolej of Edukeshon. Na Yunivasiti dey get mark wey hi pass for all di hi-ya instistushon wey JAMB dey set pass mark for.

Oga-dem for JAMB[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Kenneth Victor: E na forma Rejista
  • Ishaq Oloyede: E na di niu Regista.