John Chukwu

From Wikipedia

John Chukwu (1947-1990) na Naijá komendia, akto an MC wey pipu no as one of di Oga-dem wey stat komedi sho for Naijá. Chukwu fit do meni meni tins for entatalmet indostrie.For 1970,I akt for Ola Balogun fim Amadi an Jab Adu fim Bisi, Daughter of the River.Chukwu also bí MC for wan NTA Shanel 10 pogram The Bar Beach Show.For 1980s, e enta Komedi on stage an MC sho.

How im tek stat life an wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Edo Stet dey tek bon Chukwu in di famili of Emanuel Chukwu Ochei.Chukwu papa na gateman for forestry Department.Na Legos Chukwu tek do boiz even sey e na Igbo boi. Bifo Chukwu stat aktin, e wok forKing's College Library. Wen e kom enta sho biziness, Chukwu bin dey tok for one redio shó Join the Bandwagon on FRCN, Ikoyi. Fom 1975 to 1978, Chukwu akt as Amadi wey bi di nem of di fim wey Ola Balogun daret am in 1977. Chukwu bi pat of akto wey du Bisi, Daughter of the River wit Patti Boulaye. Chukwu somtims du DJ an wok for Club Chicago an Hots Spot. In di 1980s, e get im own Klub wey di nem na Klass Nite Klub an dia Chukwu dey do komedi. Chukwu bi di manija for di Klub til e dai in 1990.