Jump to content

Jim Iyke

From Wikipedia
(E kom from Jim lyke)
Jim Iyke
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemJim Chenj-am
Wen dem bon am25 September 1976 Chenj-am
Ples wey dem bon amLibreville Chenj-am
Unmarried partnerNadia Buari Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor, pesin wey dey rait song, businessperson Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtheater arts Chenj-am
Wie e go skulUnivasti of Jos Chenj-am
Academic degreebachelor's degree Chenj-am
Wen e stat wok2001 Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Eye kolorbrown Chenj-am
Official websitehttps://jimiykesworld.com Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

James Ikechukwu Esomugha, wey pipul no as Jim Iyke na Naija aktor wey don mek pipul enjoi beta fim lik Last Flight to Abuja wey im do wit Omotola Ekehinde an Hakeem kae-Kazim.

Im life an skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Jim Lyke for 25 September 1976 for Libreville, Gabon. Im mama an papa nem na Mr an Mrs Steven Okolue, wey dem las nem kon chenj to Esomugha from Ogwugwu Vilej for Enugu Agidi town of Anambra State. Na Jim iyke bi di onli boi for im famili wey get 8 pikin. Im go Fediral Govamet kolej, Kwali Abuja from 1985 go rish 1991. Jim Iyke stil go Yunivasiti of Jos, Pleateu Stet. Na Banking and Finance im go stodi for di skul.Im get B.S.C in Filosofi sef.

Hau im tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Jim Iyke stat to dey akt in 2001. Im dey for pipul wey dey kolet moni pass fo Nollywood, e don sho for fim wey don pas one hondred an fity(150). Jim Iyke stat im fim kompini wey bi Untamed Production in 2007. Jim Iyke stil get muzik rekod lebel wey im nam na, Untamed Records. Im do one habom wey im nem na: Who im I?, for di habom, 2Face Indibia an Sound Sultan folo join do song wit am inside.

Hau im tek dey hep pipul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Jim Iyke stat Jim Iyke Foundation for pikin wey dey Disebu wey dem do to dey helep pipul. Im go Kenya in December 2012 to go sho sey im dey sopot Make a Change Campaign. Jim Iyke go sopot dem bikos dem dey helep pipul sef. Na Christopher Grey an Cecile wey dey sing forJamiaca gada do am.

Im persona life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Jim Iyke get awod for teakwando. For April 2019, im tok for Instagram sey im don bon pikin. Na for dat Instagram, Jim Lyke teksho im wife an pikin to pipul.

Fo Januari 2021, Jim iyke tok sey im like Davido pas Wizkid, im tok dis one wen dem dey ask am kweshon abot im life for Net.

Wie dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]