Jeremiah Omoto Fufeyin

From Wikipedia

Jeremiah Omoto Fufeyin (dem bon am February 15, 1971) na di fonda an di lid pasto of Christ Mercyland Deliverance Ministry (CMDM), wey de Warri in Delta Stet Naija. Fufeyin stat di chorch on April 3, 2010.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Burutu, Warri wey de Delta Stet dey tek bon Jeremiah Omoto Fufeyin on February 15, 1971. Fufeyin papa nem na Livingson Stevenson Toboukeyei an e mama nem na Asetu Fufeyin. Fufeyin papa Mari plenti wife an e papa bon plenti pikin. For di 32 pikin-dem wey Fufeyin papa bon, na Jeremiah bi di nomba 22. E du e pamari skul for "Zuokumor Primary School " Burutu L.G.A of Delta Stet bitwin 1981 go rish 1986. Fufeyin kom du e sekodri skul for "Gbese Grammar School" Ojobo bitwin 1986!go rish 1992.

E famili life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fufeyin wife na Anthonia Fufeyin an e bon five pikin-dem for am.

Wetin pipo dey tok abaut am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pipo dey tok bad abaut how Fufeyin dey du notis me wen e dey helep pipo. Pipo still dey tok abaut how e prishin na onli on Demon an dilivans. Wen COVID-19 stil de, Fufeyin dash di pipo wey dey wok wit am, di pipo wey dey go e chorch, an Naija govamet moni wey go rish 300 million. For dat time of COVID-19 disis, Fufeyin no gree kolet offerin an tithes bikos e tok sey e wan give pipo bak tins.

Some pipo don tok bad abaut Fufeyin bikos pipo tok sey e yuz e mouth tok sey e na fest bon of T.B. Joshua. E tok sey e no tok so sey e jos dey repriset evri man of God. Meni pipo dey kol Fufeyin nems like: Warri T.B. Joshua, Niger Delta T.B. Joshua, an Ijaw T.B. Joshua. Fufeyin no gree kolet di nem-dem wey pipo dey kol am bikos e tok sey e nem na Jeremiah Omoto Fufeyin.

Wen di Tori dey Niuz sey pasto Suleman Johnson go get sex with one wuman wey no bi e wife, Fufeyin on April 1, 2017 tok sey Suleman Johnson no du dat kind tin. Fufeyin Kari anoda pasto, pasto Johnmark Ighosotu go kot in April 2022. Di risin bi sey, Fufeyin tok sey pasto Johnmark tok bad tin abaut e nem an sey one pesin menshon e nem sey e folo join du intanet wayo wen di pesin kofess for Johnmark chorch . Faya kach an skata Fufeyin chorch on 22 March 2023. E tok sey dis faya hapun to e chorch bikos e no wan lisin to wetin God de tell am.