Jeanne Scelles-Millie

From Wikipedia
Jeanne Scelles-Millie
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromFrance Chenj-am
Nem for lokal langwejJeanne Scelles-Millie Chenj-am
Fest nemJeanne Chenj-am
Wen dem bon am12 September 1900 Chenj-am
Ples wey dem bon amAlgiers Chenj-am
Wen e kpai22 March 1993 Chenj-am
Place of deathSaint-Maurice Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokFrench Chenj-am
Wok wey e dey duengineer, architect, French Resistance fighter, collector of fairy tales Chenj-am
Wie e go skulÉcole spéciale des travaux publics, du bâtiment et de l'industrie Chenj-am
Dem kip am forQ24929251 Chenj-am
Awod wey e koletMédaille de la Résistance, Knight of the Order of Agricultural Merit Chenj-am
Copyright status as a creatorworks protected by copyrights Chenj-am

Dem bon Jeanne Scelles-Millie for 12, September 1900 reesh 22, March 1993 an na French akitekshor enjinia e bi an na raita wey dem bon for Algeria, e stey for die till e get fridom from France. Shi get intrest for difrent pipu wey bi Kristen, Jew pipu an Muslim mata. Shi rait an gada difrent North America tradishon stori dem an oda tradishon stori dem. Shi an ha hosband wey bi Jean Scelles dey aktiv tu fait prostitute mata.

Ha Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na September 12, 1900 na im dem bon Jeanne Millie for Algiers an na for french family dem bon am. Shi see ha sef sey shi bi wuman wey kom from di two water side. For 1924, na shi bi di fest wuman tu kolet diploma for École Spéciale des Travaux Publics (ESTP) for Paris, an di fest wuman wey bi enjinia for akitek wok for France. Na shi bi di fest wuman wey dairekt konstrokshon wok for Algeria. Shi Mari tu Jean Baptiste wey dem bon for 1904.

Jean an Jeanne Scelles-Millies dem bi pesin wey pipu sabi well for sillonniste circles. Dis katoleek hosband an waif wey dey do well na dem fom di grup wey biliv sey na won God dey (Monotheistic) for 1934 tu bring Muslim dem, Kristen dem an Jiu pipu tugeda wit sheikh Tayeb el Ogbi wey bi won sabi pesin for islamik mata, wey start di AUMA wit Ibn Badis an di Jewish aktivist wey bi Elie Gozlan. Dis grup kom hav wikli diskoshon for rilijion mata bitwin Muslim dem, Jiu pipu an Kristen dem. For di sohma of 1935, Jeanne an Jean hep arenj for di Abbé Jules Monchanin wey bi memba of di Société lyonnaise de philosophie, tu fit mit wit di el Ogbi wey get biliv for e drim. Afta two yes di Scelles-Millies wey bi hosband an waif kom introdius Monchanin to profesoh Louis Massignon.

Jeanne Scelles-Millie hep fait for di soshia, kohshora an di politika fridom for di Algieria pipu. Na shi stat di Franco- Muslim skull dem. For di sekond Wold War (1939 go Rees 1945) shi join bodi for di French resistance an metropolitan France for Algeria. Dem put Jean Scelles for prisin sey e bi memba for di resistance wey hapun for 1941 for Algiers. E len abaut prostitushon from e mate wey dey for cell wit am, an na pesin wey dey arenj prostitut for men dem, him an e waif desaid to giv dia taim to defend human speshia value for di awieness kampen an put preshor for pipu wey dey for politiks to privent how dem dey kari pipu from won ples to anoda an yus dem for bisness mata wey no raim, na dat taim dey kom no sey na di kostoma bi di tru kos for prostitushon. Jeanne Scelles-Millie kom fainali moov tu France for 1957. Shi rait an poblish som lokal tradishon buk dem. Shi kom dai for Saint-Maurice, Val-de-Marne, for 22, March 1993. Jean and Jeanne Scelles kriet di Scelles Foundation (https://www.fondationscelles.org/en/) for 1993, an liv all dia propatee. For 1994, dem kom sabi di foundashon sey e dey yusfu for di poblik as dem dey fait agenst the yus of pipu for sex bisnes.

Som Of Wetin E Rait Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Scelles-Millie's Contes sahariens du Souf, (1964) e rait dis lokal buk bai won Arab pesin wey dey tell stori from di Kabylie for di Sahara bohda. Som of di stori na for small pikin dem an e reelet am to di yut wey dey di aj of 15 an 16. Note dem, koment dem wit som wohd dem wey get esplaneshon dey insaid di stori.

Les Quatrains de Medjdoub le Sarcastique (1966) na wetin e gada rait wey reesh 340, som kom from di wons wey e fest rait dem. E konten wetin pass 100 (quatrains) wey bi four lines of raitin dem wey e provaid wit maut bai di Khalifa familee for Algiers wey dey neva poblish. Di wok konten di sens of di kaind laif wey di raita liv, di taim wen e rait an e viu pipu bihevioh, rilijion, an wuman. Dem prisent di quatrains for di orijina an translet am wit note dem an koment dem. John Wansbrough kritisais riviu kom stat for di raitin dem dat di buk dem tu bi siriosli stodi bai di pesin wey gada difrent infomeshon bai di genre of North African colloquial literature don fail. Dem riprodius di infomeshon for a konfiusin mana. Di copi dem dey skata wit som mistek insaid di wey dem intaprit am.

Contes arabes du Maghreb wey shi rait for 1970 na wetin konten 45 stori dem wey bi sey na for Arabik or for French languej shi hie di stori dem, an faif pipu wey dey tell stori wey kom from Moroko, Algeria an Tunisia fit don tell ha di stori dem wey eesh of di stori get beta koment from pipu wey get nolej dem. Di stori dem kom from Arab tradishon insted mek e kom fro from di Berber tradishon. Sins all di pipu wey tell ha di stori dem na pipu wey sabi buk well, di stori dem sho how Arabik tradishon tek afekt di raitin. Dem kritisais di stori bikos pipu wey do di wok dem no kom out sey na dem do di wok an dem no bring out di orijina raitin for di stori raitin dem, but di stori dem get valu bikos na stori wey konten pipu bihevioh an pipu rileshonship dem.

Di Contes mystérieux d'Afrique du Nord, wey shi gada rait for 1972 wey shi kom ripoblish am for 2002, na wetin shi fit don imajin an gada from di famili of pipu wey dey rilijios dem, (pious), holy Muslim dem (meraboutic), or di pipu wey sabi law mata dem (magistrates) or from di famili of di pipu wey de du fam wok (farmer) wey de onda di simbol of di North African. Note dem wey shi diskus afta eesh of ha imajinashon stori dem tok abaot oda stori dem wit simila aidia dem. For 2003, after di deht of Algeria poblish pesin wey tok about di entre christianisme et islam tok abaot di risin an di ashuorans wey mek am soport di strogu abaot fridom for soshia, kolshora an politika mata.

E Poblikashon Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Jeanne Scelles-Millie (1964), J. Scelles-Millie. Contes sahariens du Souf, Paris: G.-P. Maisonneuve et Larose (Château-Gontier, Impr. de "l'Indépendant"), p.340
  • Abd al-Rahman al-Majdhub (1500s) (1966), Les quatrains du Medjdoub le sarcastique, poète maghrébin du XVIeme siècle, collected and translated by Jeanne Scelles-Millie and Boukhari Khelifa, Paris: G.-P. Maisonneuve et Larose, p.195
  • Jeanne Scelles-Millie (1970), Contes arabes du Maghreb (documentary collection of folklore), Paris: G.-P. Maisonneuve et Larose, p.339
  • Jean Scelles; J. Scelles-Millie (1970), "Un retour a Dieu par l'Islam: L. Massignon", in JeanFrancois Six ( (ed.), Louis Massignon, Paris
  • Jeanne Scelles-Millie, ed. (1972), Contes mystérieux d'Afrique du Nord, Paris: G.P. Maisonneuve et Larose, p.251
  • Jeanne Scelles-Millie, ed. (1973), Légende dorée d'Afrique du Nord, engravings by Clotilde Pasquier-Bronde, Noël Pasquier-Bronde, Paris: G.-P. Maisonneuve et Larose, p.216
  • Jeanne Scelles-Millie (1979), Traditions algériennes, illustrations by Clotilde PasquierBronde, Noël Pasquier-Bronde, Paris: G.-P. Maisonneuve et Larose, p.301
  • Jeanne Scelles-Millie, ed. (1982), Paraboles et contes d'Afrique du Nord, Paris: G. P. Maisonneuve et Larose, p. 170, ISBN 978-2-7068-0822-7
  • Jeanne Scelles-Millie, ed. (2002), Contes mystérieux d'Afrique du Nord, illustrations by Clotilde Pasquier-Bronde, Noël Pasquier-Bronde, Paris: Maisonneuve et Larose, p.248
  • Jeanne Scelles-Millie (2003), Fondation Scelles (ed.), Algérie, dialogue entre christianisme et islam : mémoires et notes, 1900-1974, Paris: l'Harmattan, p.181

Wie Dem Gada Di Tori[chenj-am | chenj-am for orijin]