Jump to content

Jean Jenkins

From Wikipedia

Jean Jenkins(17 March 1922-12 September 1990)na one Amerika pesin wey bi ethnomusicologist wey stey for UK an shi travul go Meni kontri dem go kolet sound wey dem rekod dem, pisho dem an instrument wey dem dey yuz tek play muzik dem.

Hau Shi Liv E Laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Jean Jenkins for Arkansas an shi stodi abaut orijin of human, Sosaiti ,Kolsho an Musicology for Missouri araund 1940 dem.For 1949, shi go Britain wit e hosband,an kontiniu to dey stodi for Yunifasiti of London for di skul wey dem dey stodi abaut pipul wey kom from East an Pipul from Afrika.Jekons travul go Meni kontri dem for Afrika an Central Asia bitwin 1950 an 1980 dem go kolet speshal tins wey dem rekod,an speshal infomshon dem.Shi get levul wel-wel among di pipul wey do speshal-speshal tin for muzik an for tradishonal muzik from difren-difren part of di wold. Shi get p itlenti tins dem wey shi kip for inside e stor.Pesin wey see or rid di wok wey Jenkins DU go see sey no bi hodinari wiman.Jenkins run komot from McCarthy,bi frend wot Haile Selassie. Jenkins na pesin wey dey wok hard an as e dey travul abaut, e dey pak e hankie an ondawear go Eni wia e wan go. For 1954, Jenkins stat to wok for Horniman Museum. Wen shi dey for di Museum, shi stat to dey kolet difren-difren instrument wey dem dey yuz for muzik from kontri wey stil dey divelop dem, an do impotant wok for Ethopia(for di whole of 1960) an shi even kriet one ples wey dem go dey stodi abautb difren-difren pipul Muzik(ethnomusicology). Araund dat time,shi Mari e sekond hosband an shi kolet British Paspot so dat dem no go posh am komot from US bikos of di Trade Unino wok wey shi dey do.Dem kom skata do marej for 1961. Jean Jenkins na wuman wey strong wel-wel an shi put mind ontop wetin shi get to do for mind araund 1960 an 1980 dem. Jean Jenkins travul wel-wel for Southern Europe, Asia an Afrika. Apart from oda ples wey shi travul go,shi go Uganda(1966-1968), Malaysia(1972), Indonesia (1973), Afghanistan(1974),Algeria an Moroko an Turkey an Syria(1975). As shi dey travul go difren ples dem, shi kolet plenti infomeshon dem for saund wey dem don rekod;Pisho an shi even dey rait som tins inside smol buk so dat shi know go foget. Shi stil kolet plenti instrument dem wey dem dey yuz for muzik. Afta shi oganaiz one program tek show (exhibition) Muzik an di instrument wey dem dey yuz for muzik for "Wold of Islam" for Horniman Museum for 1976; dis show (exhibition) mek plenti pipul kom know abaut di tins dem.For 1978, shi kompt for di Museum kom kontiniu to dey do e wok by e sef for Edinburgh, France an Gamni.For di Royal Scottish Museum in Edinburgh. Shi kpai for Lodon September 12,1990.