Janet Douglas

From Wikipedia

Janet Douglas, Ledi Glamis (Dey bon am araund 1498 an e kpai in July 17, 1537) na one big wuman for Scotland wey dey tok sey e get Witch. Dem yuz faya tek Kil Douglas dorin di time wen James V of Scotland de pawa bikos sey dey hakuss Douglas sey e na Witch

E kase as Pesin wey get Witch[chenj-am | chenj-am for orijin]

James V of Scotland no like di Douglas famili at all. Janet broda, Archibaid Douglas, 6th Earl of Angus mari di king mama. An Angus put di young James from prisin. Wen James free from Douglas famili hand for December 1528, e fest kol Janet an hakuss am sey e wan no dey obey am as king. Dey sey na Janet an odas sopot mek Earl of Augus kom to Edinburgh in June. Bikos James like Janet smol an e get one nik nem wey e dey kol Janet "our lovittis Dame Jonat Douglas" for one orda in 1529, e gri mek Janet an Patrick Charteris of Cuthilgurdy waka komot from Scotland an mek e no kom kot for jojmet. Jamie Cameron wey dey tok Histrie tok sey e bi like sey Janet no komot from Scotland bikos rekod sho sey e nem dey always enta kot kase for dat time. One of di kase tok sey na Janet kil e hosband by poisin wen e hosband kpai on September 17, 1528. Dey leta no du du di kase again an dis one allow Janet to mari e sekod hosband Archibald Campbell of Skipness dorin di dry sisin in 1537. By July 17, 1537, Dey hakuss Janet sey e an e broda , di Earl of Angus an George Douglas de plan to poisin di King.

James hakuss Janet sey e dey yuz juju or Witch am even as e bi sey James to fit prove am.Dey put Janet an e hosband for one onda ground prisin ( e hosband eskape but dey leta kil am) for one big house in Edinburgh. E no hard for James to put Janet for prisin but e hard am to get prove sey e dey witch am bad. Wetin James du bi sey, e allow mek dey flog Janet famili memba an savant. Dey tok sey Janet na witch an dey bon am wit gaya on July 17, 1537 for di big house wey de Edinburgh. Dey mek suo sey Janet smol boi dey luk as faya de bon e mama.