Jane Hicks Gentry

From Wikipedia

Jane Hicks Gentry (dem bon am for December 18, 1863 - e kpai May 25, 1925) na Appalachian pesin wey dey stodi an sing abaut lokal tins, dem bon am for Watauga County, North Carolina. Plenti pipul sabi am bikos of di way wey e dey ask question an "Jack Will, and Toms Tales", wit di song e rekod Cecil Shap, plenti pipul sabi sey dem stat for England, Scotland or Germany, an kon pas to Jane's famili bifor e kon rich am.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na im bi di sinior for hol di five pikin wey Emiley Harmon an Ransom Hicks bon. Im broda an sista na John Riley, Mary, Magaret Elizabeth an William. Dia famili kom fom England, dem dey insaid famili wey American Revolutionary War mek dem kom America. Na fom Wurttemburg, Germany im fore fadas kom bifor dem kin dey stay for Amerika, bifor di America Revolutionary war, wen Emily dey 12 or 13 years old, dem folo oda famili muv go Maddison County, on di Meadow Fork of Spring Creek, na farm wok e dey du for dia. Meni times wen Emily dey wok insaid im haus, wen smol pikin gada am, e go dey sing for dem an dey ask dem question wey go mek dem think an tel dem stori wey don dey for long insaid Harmon famili. Jane no too go skul, but e len hau to read wey mek am fit read di Bible.

E mari Gasper Newton "Newt" Gentry in 1879, an dia two get nine pikin. (Lydia Nora, Martha Emily, Mary Magdalene, Alfred Chanay, Allie Mae, Lillie Bertha Maud, Roy Stevens, Lalla Marvin, Nola Jane). Na for Hot Springs dem bon dia las bon. Wia dem buy land to dey uze for famin an dey train anima. Gentry pikin go Presbyterian-run Dorland Institute, na fom wetin dem get fom di fam wey Newt dey, dem uze dey pay skul moni. Jane wok insaid di skul. Afta som time, na im kon dey chek pikin wey dey wok for di skul, meni pipul sabi Jane for di skul bikos of hau e dey tel dem stori, sing an danc for dem.

Afta som time, e stat to dey wok for wia skul pikin dey liv. One of di famili frend tok sey e sabi wok an mek odas wok sef. Sey e lik to tel storis an sing. Di United States Govment later chenj Montain Park Hotel wey dey Hot Spring to wia Wold War 1 German sailor wey dem kash kamp. Som of dia famili liv for town, an som na for wia skul pikin dey stay for Jane House.

Songs an Storis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pesin wey dey gada lokal song Cecil Sharp an im frend Maud Karpeles kom Appalachia bikos one America pesin wey dey rait an sing lokal song Oliver Dame Campbell ask dem to kom mek dem gada old lokal song an short song stori insaid 1916. Pesin wey dey kontrol Dorland dat time, Lucy Shafer advis dem mek dem kol Jane Gentry. Fom August 24, 1916 rich July 27, 1917, Sharp an Karpeles chek Jane's songs, dem kolet 70 of im wok. Sharp no tok wia di song kom fom, but tok sey most Appalachia short stori lokal songs kom fom England or Lowland Scotland. Holgar Nygard, wey bi profesor for English for Duke University, tok sey na fom Scotland na wia planti of Jane's wok, anoda pesin Brain Peters, wen e stodi Sharp's Appalachian wok, sho sey smol song stori lik "Barbara Allien", "Little Musgrave" an "Lord Thomas and Fair Ellender" kom fom England.

Jane dey kol im stori "Jack, Will and Toms Tales". Betty N. Smith wey bi singa an dey du wey sabi histri mach di song to German Märchen pipul wey don live an du gret tins, but stil tok sey dem fit bi Hick's English fore fadas. Irving Bacheller wey dey rait buks an im wife Anna fest ci Jane insaid wia school pikin dey stay in 1914, wia e dey tel smol smol pikin storis an ask dem question wey go mek dem hapi. Di Bachellers hapi sotey dem tel am mek e Kon ci dem for Greenwich, Connecticut.

Wen Betty N. du im findings, di visit dey insaid Bacheller's buk Tower of hundred Bells, wey spoil wen fire bon in 1917, wen Jane kpai pipul stil kon no sey no bi lie, insaid one letter wey Bacheller rait to im pikin Maud Long, e rait for di letter say, e rait abaut im mama an hau e tek liv life, but fire don bon di buk insaid im house in 1917.

Dem gada fifteen storis wey Jane du insaid twenty-three buk wey Isabel Gordon Parker du in The Journal of America Folklore 1925. Di oda stori buk wey dem du for pipul to read na six by Sevier County, Tennessee, an two storis by John Campbell of Townsend, Tennessee. Carter, wey bi pesin wey dey stodi lokal tins tok sey dem kollet Jane song an no too luk di storis. Wen dem ask Jane mek e tok abaut im wok, e tok tru sey storis don dey down sins im great grandmoda to im great grandfada Council Harmon.

Jane pikin wey bi girl Maud Long leta rekod som of im mama stori for di Archive of America Folk Song at di Library of Congress.

Hau e tek kpai[chenj-am | chenj-am for orijin]

Newt Gentry kpai March 24, 1992.

Jane kpai in May 1925. Insaid di paper wey dem tek tel pipul sey e don kpai, dem rait insaid sey e sabi Engish old songs an shi sabi Scottish lokal songs.

Som of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

. Smith, Betty N. (2015). Jane Hicks Gentry: A Singer Among Singers. The University Press of Kentucky. ISBN 978-0-8131-4835-9 – via Project MUSE.