Jacob Odulate

From Wikipedia

Chief Jacob Sogboyega Odulate (1884–1962) wey pipul no wel wel as Blessed Jacob na Naijá pesin wey dem mek medisine, dey mek niu-niu tins, rait abaut diferent tins. E get im own biznes an na im du one medisine wey dem dey kol Alabukun.

How im tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

No bí only one waif Jacob papa marri an dem dey kol im papa Pa Odulate. Na for 1884 dem tek bon Jacob for Ikorodu. Di man wey bon im mama nem na Chief Aina Odukanmade di fest Moslim wey e papa kom fom Senlu wey bí one pat of Ranodu famili for Imota, wey dey near Ikorodu. Wen Jacob dey 14 years, e komot for e papa house for Ikorodu go Abeokuta for Ogun stet. Na 3 month e tek yuz leg waka rich where e dey go. Wen e rich Abeokuta, e meet one man wey dey du medisine. Di man nem na Dr. Sapara. Na dis man tich am di smol-smol sens wey dey help pesin fit du medisine.

Na wen Jacob dey as yong man, e opun e own kompini wey dem dey kol Alabukun an di kompini dey du diferent-diferent medisine.

Alabukun medisine[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 1918, (di year wen di British Pipu rili wan rule us), for one evinin for inside e smol kompini wey e like wel wel wey e dey kol "headquaters" for Sapon for inside Abeokuta wie e fest build di headquaters of e kompini wey get bot wie e dey wok, e ofis, di room wey pipul fit kom tok to am abaut dia problem an di ples wey im tek dey mek im medisine. Jacob kom try to du di Alabukun dat veri day. Na im waif an im pikin-dem join am du dis medisine. E kom stil du oda tins like Alabukun Mentholine an one buk wey im dey sel every year wey dem dey kol Alabukun Almanac wey rili sell wel-wel fom 1920 to 1950 for Abeokuta an odas ples near Abeokuta.

Wen e dey du di medisine, almost all di tins wey dem yuz du di medisine kom fom Liverpool for United Kingdom. Na acetylsalicylic acid an caffeine bi di main tins wey Alabukun pauda get. One paket of Alabukun get 760 mg of acetylsalicylic acid and 60 mg of caffeine wey kom mek evritin bi 820 mg and odas tins wey dey mek di medisine last long and evritin kom get 1000mg pauda an di total weight go rich 1400mg. Som of di tins di medisine dey wok for headik, pesin wey teeth dey pain, pesin wey throat dey pain, e dey hep mek blood no gum togeda for bodi like sey na akamu, pesin wey bodi dey pain, heart attak, pesin wey im blood no dey flow wel for bodi an pesin wey no dey breet wel. Dis medisine dey wok wel wel an e dey hep put adenosine for inside bodi. E dey hep stop pain for bodi an hep pesin to dey breath fine. If pesin no yuz am wel, e fit kos mek plenti tins like wota plenti for pesin bodi, e fit no mek pesin breet wel, e fit dey mek pesin vomit, an e fit mek pesin belle dey du am one kind and e go mek pesin eye dey see doubu

For 100 years now, dis podut don dey sel wel wel for evriwia for Naijá, for Benin Republic, Cameroon, Ghana an som pat of Europe. For now, na one of di grand pikin of Chief Jacob Odulate wey e nem bí Koye Odulate dey manej di kompini.

Im Family[chenj-am | chenj-am for orijin]

Jacob Odulate waif bi Sekumade Abiodun Odulate. E let all im pikin go skul wel wel. E yuz di moni wey e gain from im bizness tek send im pikin-dem go skul for Durham, Newcastle, United States an London so dat dem go bikom pipul wey dey tich odas pipul, dokto, loya an enginia. One of e pikin na Chief Mrs. Folake Solanke née Odulate wey bi di fest wuman to be SAN for Naijá.