Isidore de Souza

From Wikipedia
Isidore de Souza
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromBenin Chenj-am
Fest nemIsidore Chenj-am
Famili nemde Souza Chenj-am
Wen dem bon am4 April 1934 Chenj-am
Ples wey dem bon amOuidah Chenj-am
Wen e kpai13 March 1999 Chenj-am
Place of deathCotonou Chenj-am
Manner of deathnatural causes Chenj-am
Cause of deathmyocardial infarction Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokFrench Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician, Catholic priest, Catholic bishop Chenj-am
Post wey e deyCatholic archbishop Chenj-am
RilijonCatholic Church Chenj-am
ConsecratorBernardin Gantin, Bernard Yago, Christophe Adimou Chenj-am

Isidore de Souza (Dem bon am for April 4, 1934 an e dai for March 13, 1999) na one priest wey kom fom Benin an e bi Arkbishop of Cotonou fom 1990 go rish 1999. Dem bon am inside one rich famili wey dem dey kol De Souza famili of Ouidah for April 4 1934. Na e broda bon Chantal Yayi wey bi di Benin Presido waif fom 2006 to 2016 an Marcel Alain de Souza (1953–2019) wey don dai. E wok for bank an e bi di oga pata-pata for ECOWAS Commission. De Souza stil go skul for Abidjan an Rome. Na for July 8, 1962 dem mek am priest. For July 8 1962, dem mek De Souza di Coadjutor Archbishop of Cotonou an e kom bi Arkbishop on di 27 of December 1990. Na e bí di lida for di Nashional Konferens for February 1990 wey dem plan to yuz am tok abaut di wey tins bí for di kontri bot e chenj Benin back to demokrasi. E rili put bodi for dis one so dat armi no go kom skatta dis one. De Souza wok as di oga pata-pata for di Hi kansu of di Republic fom February 28, 1990 to March 31, 1991. E kom stat di taim wey pipul go chuz di pésin wey go rul dem for Benin and di niu law wey go tok abaut all di tins wey evribodi supoz du anbdi one wey dem no go du. Isidore de Souza beg Presido Mathieu Kerekou to assept di tin wey dem don agree for di Kansu an stil riton Benin bak to Demokrasi. De Souza na di oga pata-pata for di Regional Episcopal Conference of Francophone West Africa fom 1997 ontil e kom dai. E die for March 13, 1999 for Ouidah.