Irene Whitefield Holmes

From Wikipedia

Irene Whitefield Holmes(nss Irene Therese Whitefield;26 October 1900-10 May 1993)na one Amerika pesin wey bi enthnomusicologist,educator an pesin wey pipul know wel-wel sey e dey kolet Cajun,Creolean an Louisiana frensh folk song dem.

Hau E Liv E Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Irene Therese Whitfield for Rayne, Louisiana.Na shi bi di sekond pikin inside ten pinkin dem,of seven girl three boy dem.Na for inside dia famili Rice farm wey dey for La Belle Savanne,bitwin Doscon an Rayne wey bi two smol toaun for Acadia parish naim shi grow up.Im an Lauren Chester Post wey dem bi relativ an wey bi Cultural geographer an educato dey Liv near dem sef on top dia fada farm dem Whitefield go Southwest Louisiana Industrial Institute(dem don chenj di nem to University of Louisiana Lafayette),an shi graduat for 1919. Shi kon get e masters digri from Louisiana Stet Yunifasiti,an PhD from di Yunifasiti of Chicago for 1924. Whitefield kom stat to kolet an arenj Louisiana folklore song dem. Wen Patricia Petnik dey rait ,shi diskraib Frensh langwej folk muzik,asgenre existed on the eye of the beholder. For di bigin of 1939 Louisiana Frensh folklore song dem, Whitefield rait sey e dey veri difikot to sepret di song dem bot bikos dem need to grup di song dem, e stil arenj dem wit di Frensh wod wey dey inside di song dem. Daniel Kingman sef tok abaut Whitefield folk muzik for SouthernLouisiana,wey shi do on top difren Kolsho of komuniti dem wey dey for di rijon.E tok sey: Whitefield don show three difren set dem; Louisiana -Frensh, di pipul wey dey dia an wey dia grait -grand pikin dem wey kom from Frans or from Carribeans;or from di Acadians or Cajuns,refuji dem from Acadia(wey bi Nova Scotianau)an wey dem welkom to Louisiana,an Spanishrula dem dash free land afta dem poshu dem komot for Canada for di midu of eightteenth senturi an som pipul wey kom from Afrika. Wit dis difren set dem,e show sey Whitefield folo Profeso James Broussard of Louisiana Stet Yunifasiti. Di Profeso tok sey di three forms of Frensh na : Louisiana-Frensh,Acadian, an ' 'Negro- Frensh' or Creole