Ini Edo

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Ini-Edo-1

Iniobong Edo Ekim (dem bon am for April 23, 1982) na Naijá aktres. Ini Edo stat e fim karia for 2000 an e don akt for more dan 100 muvi-dem sins e stat to akt. For 2013, Ini Edo bí joj for di Miss Black Africa UK Pageant. For 2014, United Nations chuz miss Ini Edo as United Nations Habitat Youth Envoy.

Tori of e life an skul way e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ini Edo na Ibibio wuman fom Akwa Ibom stet for south-south pat of Naijá, nia Calabar. E mama na skul tisha, and e papa na choch elda. Ini Edo bi sekond pikin out of four pinkin-dem wey e mama an papa bon, dem bi three gels one boi. Na strong hand dey yuz train Ini Edo. E go Cornelia Connely College for Uyo, Naijá . Ini Edo go University of Uyo wia e get Diploma for Theatre Arts. Ini Edo get bachelo digri fom University of Calabar wia e rid Inglish. For 2014, e get skularship to rid law for National Open University of Nigeria.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

The first movie wey shi akt na Thick Madam for 2003. Na one producer dicover Ini Edo wen she go for audition. Ini Edo blow for 2004 when she akt for the movie 'World Apart'. She don akt for more dan 100 film-dem. Dem give her "Best Lead Actress" nomination for di 11th Africa Movie Academy Awards for ha performance for di movie "While you slept".

For 2017, Ini Edo talk sey na only hardwork, delight an dedication fit helep persin succeed for Nollywood industry bikos plenty-distraction dey.

E pasona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2008, Ini Edo mari Philip Ehiagwina wey bi American-based bizines man. Di marej skata for Septemba 2014, afta six years. Ini Edo get e fest pikin wey bi girl by anoda wuman wey hep am kari di bele for 2021.

For April 2023, Ini Edo bin tok say di tori of ha rileshonship wit felow aktres Empress Njamah's bifor boyfriend, George Wade, na jos rumor and e nor be true.[1]

Endorsement wey e du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ini Edo don bi GLO brand ambasado for ten years from 2006 go rich 2016. For 2010, Ini Edo bi di brand ambasado for Noble Hair. Ini Edo na brand ambasado for Slim Tea Nigeria. For 2019 dem mek Ini Edo ambasado for di @MrTaxi_NG brand.

How e tek wok for politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem mek Ini Edo Speshal Asistant to di Akwa Ibom Stet Govno for Culture and Tourism for 2016.

Awods an nominashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Event Prize Pesin wey kolet am Resot Ref
2009 2009 Best of Nollywood Awards]] Best Actress Leading Role (Yoruba) won
2011 Zulu African Film Academy Awards Best Actress Indigenous Edika Nigeria won
2012 2012 Golden Icons Academy Movie Awards Best Actress In Leading role In a cupboard nom
Female Viewers Choice Herself nom
Honorarium Appreciation Award won
2013 2013 Golden Icons Academy Movie Awards Female Viewers Choice won
Cross River Movie Award Best Act Female(English) Behind The Melody won
Nafca Best supporting Actress Weekend Getaway won
2014 2014 Golden Icons Academy Movie Awards Best Actress Leading Role Nkasi The Village Fighter nom
Best Comedic act nom
Best Actress-Viewers Choice nom
2015 2015 Golden Icons Academy Movie Awards Best Actress While you slept nom
Female Viewers Choice nom
2015 Ghana Movie Awards]] Best Actress - Africa Collaboration won
11th Africa Movie Academy Awards]] Best Actress Leading Role nom
2016 2016 Africa Magic Viewers Choice Awards Best Actress in a Comedy Desperate housegirls nom
2016 Nigeria Entertainment Awards Best Actress - TV Series nom
2018 ZAFAA Global Awards Best Actress While you slept won
2021 Net Honours Most Popular Actress nom
Africa Movie Academy Awards Best Actress in a Supporting Role]] The Citation]] nom

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Ogedegbe, Isaiah (27 April 2023). "Ini Edo Debunks Rumours Of Her Affair With Empress Njamah's Ex-Boyfriend". Opinion Nigeria. Retrieved 10 May 2023.