Indonesia

From Wikipedia
(E kom from Indonishia)
Jump to navigation Jump to search

Indonesia,[1][2] (ɪndoˈnesia) wey ofishali bi di Repoblik of Indonesia, bi di ofishal nem wey dey in yuz pas, dou di nem Unitari Staet of di Repoblik of Indonesia (Negara Kesatuan Repoblik Indonesia, NKRI) also dey apia for som ofishal dokuments.}} bi wan kontri for Sauteas Asia and Oceania bitwin di Indian and Pacifik ocean. E dey konsis of ova 17,000 ailands, inkludin Sumatra, Java, Sulawesi, and pats of Borneo and Niu Gini. Indonesia bi di lajes ailand kontri for di wold and di 14th-lajes kontri bai erea, at 1,904,569 km². Wit ova 279 milion pipo, Indonesia bi di foht-mos populous kontri for di wold and di mos populous Muslim-maejoriti kontri. Java, wey bi di mos populous ailand for di wold, bi hom to moh than haf of di populaeshon of di kontri.

Indonesia bi a presidenshal repoblik wit elected lejislaechor. E get 38 provins, of which nain get speshal autonomous status. Di kontri kapital, Jakarta, bi di sekond-mos populous oban erea. Indonesia dey shia land bodas wit Papua Niu Gini, Eas Timor, and di eastan pat of Malaysia, as well as maritaim bodas wit Singapo, Vietnam, Tailand, di Filippins, Austrelia, Palau, and India. Despait e laj populaeshon and densli populaeted rejions, Indonesia get vast erea of wildanes wit di sekond-haies levul of baiodaivasiti for di wold afta Brazil.

= Also si[chenj-am | chenj-am for orijin]

Referens[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. "INDONESIA | Meanin & Definishon for UK Inglish | Lexico.com". Lexiko Dishonaris | Inglish (in Ínglish). Archived from the original on 2020-02-28. Retrieved 2022-05-07.
  2. Templet:Cite Merriam-Webster