Ikeja city mall

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Di Ikeja citi mol na mol wey dey for Alausa for Ikeja for Lagos stet. Na im bi di fest of im kind for di meinland for inside Lagos taun.for inside di moll get sivabed an cinima an ivun get ShopRite,fain ples wey pipu dey chop beta food, difrent bank ATMs. For evriwhere pipu no am as ShopRite ikeja or ICM. Dem dey use am as ples wey frend-dem and famili fit mit an joli, an for biznes pipul.


Hau Di Biudin Stat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di ikeja citi mol dem stat to dey biud am for May 2010 an dem bi won mek i opun for tradin November 2011. Bot i no wok aut like dat so dem kom finalli open am for lat December. One of di tin we diley di wok bi sey smol pat of di biudin fol wey bi sey i wund five pipu wel wel an dis wan hapun for Thursday 9 December 2010.

How dey disain di biudin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di shopin senta get 5 skreen sivabed sinima (na im bi di onli cinima tiata for ikeja) an shoprait supamaket. Di biudin get plenti oda fasilitis like dipartmint stores,banks, kafes,bars,restorants, airdressing/biuti salun, ici-skatini arina etc.

Expansion[chenj-am | chenj-am for orijin]

For ikeja citi mol to fit sav kostoma-dem wel wel dem nid to expand di biudin an go mek am intanashonal an lokal bands. Akodin to di senta managa di niu biudin go get pikin-dem inside, sinima hol na fud kurt. Ol dis wan go mek di mol komfótebu for evri memba of di famili.

Jun 2012 shotdaun[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ol di mol shotdaun for June 12 2012 bikos pipu kom aot kom dey tok sey dem no go gri for d niu pakin fii wey di administreshon bring kom, we bi 300naira for one awa pipu dem sey dem no go gri dat prais so for dis rison dem shotdaun di mol.