Ifeanyi Palmer

From Wikipedia
Ifeanyi Palmer

Ifeanyi Palmer na di Naija pastor, lida, fonda an oga kpatakpata of di Gospo Harves Asembli,[1] wey pipul also sabi as Word Arena, an im chorch headkwotas dey for Warri, Delta Stet, Naija.[2] Isaiah Ogedegbe don kol am "di man wey tok di Word an destinis dey chenj".[2]

Ministri[chenj-am | chenj-am for orijin]

As pesin wey God don kol to tish an prish di Word with signs, wondas an testimonis of healings wey dey folow im ministreshon, Ifeanyi Palmer bin stat im fest chorch for 1999.[3] Di mishon of im chorch na to raise men an wumen wey go dey strong in di Word, full of pawa, wisdom an grace, wey go dey yuzful to God an di world today.[4]

Di vishon of im chorch na to prish di gospo all ova di world, to train an mobilize men an wumen for di work of di ministri, to bring revival an evajelistik help to chorches tru krusade an revival seminars, to spread di Word tru media, to do soshal an komuniti work by establishing an maintaining fasilitis for di nidi.[4]

As ogbonge tisha an prisha, Ifeanyi Palmer today dey funshon onda di apostolik anointing wey don chenj men an women tru di Word an preya.[3] Akording to Isaiah Ogedegbe, Ifeanyi Palmer "na a man wey God truli kol and give ogbonge anointing, an e don dey yuz am to demonstrate di pawa of God for di fridum of all pipul".[2]

For Septemba 25, 2022, di Opinion Naija bin ripot sey a residet pastor for one of Ifeanyi Palmer's branches wey dey for Merogun insaid Warri, Pastor God'spower Okolo don tok sey mek kristens espeshali membas of di chorch dey wear di luv of God jos as pesin dey wear klot for im bodi.[5]

Pej wey konsan dis one[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Nkanteen Juliet (27 August 2019). "Shamar School Celebrates Cultural, Creative Arts In Practical Examination". Fresh Angle News. Archived from the original on 3 December 2023. Retrieved 3 December 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  2. 2.0 2.1 2.2 Isaiah Ogedegbe (23 September 2022). "Pastor Ifeanyi Palmer: The man who speaks the Word and destinies are changed". Opinion Nigeria. Archived from the original on 3 October 2022. Retrieved 3 December 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  3. 3.0 3.1 "Meet the Palmers". Palmer Outreach Ministries. Archived from the original on 2018-08-26. Retrieved 2023-12-03.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  4. 4.0 4.1 "What We Believe". Palmer Outreach Ministries. Archived from the original on 2018-08-26. Retrieved 2023-12-03.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  5. Isaiah Ogedegbe (25 September 2022). "Pastor Godspower Okolo charges Christians to be clothed in God's love". Opinion Nigeria. Archived from the original on 7 October 2022. Retrieved 3 December 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)

Extanal links[chenj-am | chenj-am for orijin]