Ibrahim Gambari

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Ibrahim Agboola Gambari CFR ( dem bon am for November 24, 1944) na Naijá pesin wey bi di Shif of Staf for di Presido of Naijá.

=Tori of e life an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ibrahim Agboola Gambari for November 24, 1944 for Ilorin for inside Kwara stet in a Fulani Roya famili. Na im broda pikin wey dem dey kol Ibrahim Sulu Gambari bi di Emir for Ilorin. Gambari go skul for King's College for Legos. Afta dis wan, e kom go one big skul for London wey di nem bi London School of Economics. Na dia e kom get one satifiket wey dem dey kol B.Sc(Economics) in 1968.Gambari kom rili len abaut how pipul dey du tins wit demsef for di hol wold. E kom stil get anoda satifiket wey bi M.A(1978) an ph.D(1974) fom Columbia University wey dey for New York inside USA afta e don rid politiks mata/how pipul tek dey do tins wit demselfs for di whole world.

How e tek stat to tich for skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Gambari stat to dey tich for 1969 for siti Univasiti of New York bifo e kom wok for Univasiti of Albany. Afta, e kom ticb for Ahmadu Bello Univasiti wey dey for Zaria inside Kaduna Stet. From 1986 go rich 1989,e bi Professor wey dey tich for three difrent big big skul for inside Washington, D.C. Their nem na Johns Hopkins School of Advanced International Studies, Georgetown Univasiti an Howard Univasiti. E don stil join pipul to du one kain wok wey dem dey fain out abaut som kain tins for Brookings Institution still inside Washington D.C. and e stil dey du one wok wey dem dey kol Resident Scholar for Bellagio Study and Conference Center an for Rockefeller Foundation-run center for Italy. E don rait plenti buk an put dem for ples wey get levul wel wel abaut how pipul tek dey du tins wit demself for di hole wold.One of di buk nem na Theory and Reality in Foreign Policy: Nigeria after second Republic.

=How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Gambari wok as di oga pata-pata for enitin wey konsain Naijá an oda kontri fom 1984 to 1985 for di taim wey bi sey na General Muhammadu Buhari bi di Army pesin wey dey rul di hole Naijá. Afta dis one, e kom bi di oga pata-pata for Nigerian Institute of International Affairs (NIIA) fom 1990 rich 1999. Na im bi di onli pesin wey don tey wel-wel as pesin wey go stand for Naijya for inside United Nations, e wok onda five different pipul wey rul Naijá.

United Nations

Gambari wok for diffrent-different ples inside United Nations. For 1999, na im bi di oga pata-pata for UNICEF, afta e kom bi di UN Under-Secretary-General. Gambari bí di pesin wey dey giv di oga pata-pata for UN wey e nem bi Kofi Annan advais abaut Afrika fom 1999 to 2005. E stil bí di fest Under-Secretary-General for di United Nations abaut Politiks mata from 2005 to 2007 wen di oga pata-pata bi Kofi Annan and Ban Ki-Moon. Di last wok wey dem giv am for inside UN na for 2012 wen Ban Ki-moon and di oga pata-pata for di Arican Commission mek am di Joint African Union-United Nations Special Representetiv for Darfur.

Tins wey dem giv am as respet an grup wey im join[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Na im stat Savannah senta and na im bi di oga pata-pata.
  • Gambari stil folo bi di oga for Albright-Gambari Commission.
  • E dey for one grup wey dem dey kol Johns Hopkins University's Society of Scholars.
  • Naijá govment giv am one taitul wey dem dey kol Commander of the Federal Republic (CFR).
  • University of Bridgeport giv am one satifiket wey dem dey kol honoris kourse an one taitul wey dem dey kol taitul of Doctor of Humane Letters (D.Hum.Litt.).
  • For March 4 2013, di Govnor of Kwara wey im name be Abdulfatah Ahmad mek Ibrahim Gambari di oga pata-pata for Kwara State University.