I Go Dye

From Wikipedia

Francis Agoda (dem bon am on April 4, 1979), plenti pipu sabi am for im wok as I Go Dye na Naija pesin wey dey mek pipu laff. E bi raita, e dey tok to advais pipu. E don du plenti sho for Naija lik "I Go Dye Standing".

Tori abaut im life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hau e tek stat life

Dem bon Francis Agoda on April 4, 1979. In Abraka, Delta State, Nigeria. Wen e dey smol, na im granmama ples for water side wey dey Okpara e stay. Na for im granmama, Queen Agnes, e tek ci wetin pipu dey fes for smol vileji in Nigeria. Na hol di tins e ci mek am dey tok abaut wey dey mek pipu laff an e dey rait am for buk.

Hau e tek stat to dey mek pipu laff na fom wen e dey primary skul for Ighogbadu primary skul, an College of Commerce, Warri Delta State. Wen e dey skul na memeba of Junior Engineering Technical Society. In 1992, smol pikin wey e bi, e meet di govnor of Delta State|stet Olorogun Felix Ibru afta e don trai to bi di fes pesin wey go kom fom vilej kon du hovacraft ship, radio, hair drya, projetor, elektrik solar teble fan, an helicopta wey dey fly, na e kon leta bi di onli smol pikin wey go du flying helicopta an muving hovacraft ship. Dem kari am go stodi engineering for New York University for free.

I Go Dye lik komedi, na im mek pipu sabi am wel wel fas fas. Bikos of di tins e don ci wen e dey gro up for vilej, e uze as pipu tek no am an moni wey e get tek dey hep smol pikin an pipu wey no get.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na fom im reel nem Agoda, e tek chenj to I Go Dye, wey di mean hau to dey hep yung pipu.

Wen e dey college, im mama komot am for di United College of Commerce to Essi College, Warri, bikos im broda, wey bi ticha for Essi College dat time, fit dey chek am.

Wen e dey Essi college, e join SVC wia e tek meet im bes frend, Otagware Onodjeyeke (Ltas) wey dem sabi nau as Igosave. Dia tu dey tok smol nius on Delta Brodcasting Service 1994, wia dem dey tok abaut tins wey dey hapun for Naijà. E get kontart for Prest Motel in Benin City, wia dem dey pay am 1000 naira for one sho.

Afta plenti years wey e don du komedi for plenti ples insaid di kontri, dey kon kol am for Naijà komedi sho wey bi Night of a thosands laughs (year 2000 edition). E dey insaid pipu wey go sel market pas for komedi sho, na wetin Ibaino wey du di sho tok bi dat.E du sho for Opa Williams, wey du Nights of a Thousands Laugh, wey mek am giv am awod of komedian wey dey difren pas for staj of Nights of a Thousands Laugh for ten years.

Di fest time wey e go Europe to du plenti sho na wit Ehi Zoya Golden Entertainment (2005), wey mek am go 7 kontris. France (NIDOE) kon leta kol am kom pafom for di UNESCO Cultural Week insaid Paris, France. Niddo Spain leta giv am awod bikos of di kain wey e dey mek pipu sabi Naijà kolture.

E du sho for Opa Williams, wey du Nights of a E dey insaid MTV Afrika Music Awod, e don du sho to open an klose sho for difren ogbonge singa lik Akon, Boyz II Men, 50 Cents, Rick Ross, Di Game an Kelly Rowland.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

I go dye don win plenti awods, na im win: . African Bes Komedian .Di Nigerian in Diaspora Organization of Europe-SPAIN Awod as e tek put bodi to kari Naija kolture up. . Di Nigerian Bes Komedi Awods (NEA Awods) .Delta Role Model Awod 2017 .Nigeria Bes Komedian Awod .Niddo Spain Awod; as e tek put bodi for Naija kolture an Art . .UKaid an Youth alive foundation Awod ambassador Awod on #MadAct, mek a difren against koruption Todey; wey Dem du for Naija pensioners. .Nigeria Army Civil Awods wit di komplement of Chief of Army Staff Lt General TY Burutai. .United Nations Wod Habitats Ambassador.

Oda tins wey e du[chenj-am | chenj-am for orijin]

I go dye's komedi brand na I Go Dye Standing. In 2016, I Go Dye sel wel wel for O2 London sho wey e tek du im 20 years on staj. Bifor di I Go Dye wod tour, e pafom for Afrika komedi sho wey MTV Afrika Music Awods dey insaid. Plenti big pipu lik I go dye sho wey mek politishian, Presidents an oda ogbonge pipu lik to dey kol am. E pafom for di 2018 Nashonal Council of Nigeria Tradishonal rulers, wey dem du for Port Harcourth wit di Sultan of Sokoto, Alhaji Sa'ad Abubakar III, Oni of Ife Adeyeye Ogunwusi, an plenti oda ogbonge pipu.

E bi Millennium Development Goal ambassador, wey dey wok for United Nations for dem to du wetin dem plan to du. In September 2014, dem ci I Go Dye an Cross Rivers stet Govnor Liyel Imoke, for pisho insaid di Nigerian Ireland Carnival in Dublin.

Hau e tek dey trai chenj tins for beta[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hol wetin I Go Dye don ci for smol mek am wan to dey hep pipu an chenj tins. Dey shot am an som of im frend don kpai bikos dem wan chenj tins. Bikos of wetin e don ci for insaid faight wey hapun insaid 1997 for Warri, wen Itsekiri an ijaw dey faight, e kon du one projet, Peace in sight. Amb I Go Dye du 10 minutes shot film, E du di fim insaid 2004 for United Nations an for Fediral Govment of Nigeria to uze am mek peace an hep smol smol vilej pipu.

E don uze buk an vidio hep ogbonge pipu. E rait letter wey evribodi ci for di govmet insaid 2017, na wen dem dey du World Youth day e rait am. Di nem wey e giv wetin e rait na "Logic an Reasons Without Guns", e rait am for Naijà Govment an Pipu wey dey faight for govnor an di youth.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. I go Dye: The fabulous lifestyle of a comedian. Vanguardngr.com. 13 September 2014.

2. Nigeria Army honours I Go Dye.. Vanguard newspaper 3 July 2017.