Husaini Abdullahi

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Vice-Admiral Husaini Abdullahi (March 3, 1939 – July 9, 2019) na Naijá armi man wey rul Bendel stet for Naijá fom March 1976 go rich July 1978 for di taim wey General Olusegun Obasanjo bi di Armi pesin wey dey rul di hole Naijá.

Dem born Husaini Abdullahi for March 3, 1939 for Doma Lokal Govment wey dey inside Nasarawa Stet for Naijá. Wen e bi lieutenant kommanda, na Abdullahi dey kontrol som grup of armi wey kom from NNS Lokoja for di taim wey dem tek kolet Bonny Island for July 1967, for di taim wey di Civil war for Naijá tek hapun. For July 30 1975, di new pesin wey dey rul Naijá wey dem dey kol Brigadier Murtala Muhammed tok sey dem don send Kaptain Abdullahi to wok for di Supreme Military Council. General Olusegun Obasanjo stil mek am Commodore Abdullahi di gofnor wey bi Armi wey go dey rul Bendel Stet fom March 1976 go rich July 1978.

Afta e don work finish for Navy as vice-admiral, Abdukkahi kom bí di oga pata-pata for dem di pipu wey dey kontrol Inland Bank Nigeria.