Hester Jonas

From Wikipedia

Hester Jonas ( wey dey bon araud 1570 an e kpai December 24, 1635) na German norse an Wayo wuman.Dey Kil-am bikos e na witch.Pipul sabi am wel wel as "Witch of Neuss.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Dormagen dey tek bon Hester Jonas.Wen e mari miller Peter Meurer, dey komot go live for Neuss.Afta e marej, Hester Jonas stat to get epiletik an shoki.E kom wok as norse wey dey tekia of mama an dia pikin an pipul biliv sey e get wayo wel wel. Hester Jonas no how to yuz plant an tek trit pipul espeshali Mandrake. Wen Hester Jonas bi 64 years, pipul hakuss am sey e bi witch, dey harest am, ask am kweshon, flog am an kari am kom di kot mek e faze Mayor or joj of Neuss.Di kot pass jojmet sey Hester Jonas don du padi padi wit Devil.Di kot fest lisin to e kase for November 15, 1635 an dey kom du e sekod yeerin for November 22, 1635. Hester Jonas tok sey e no bi witch an sey na lahi bi all di tins wey pipul dey tok abaut am. Afta wey Twenty-Eight days don pass for December 19 an 20, dey forse am to sit-down on top of chair wey pin or nail dey for almost three hours.Afta wey dey don beat Hester Jonas wel wel, e kom konfess sey e slip wit one blak man wey e nem na "Hans Beelzebub" an sey e dey damej hanima an human bein wit blak majik. Hester Jonas eskape from wey dey lock am bot dey stil kach am bak. Hester Jonas stil no gri sey na witch not wen beatin too plenti e gri sey e na witch di next day Afta dey kach am.Wen e don gri for all di tins wey pipul tok abaut am, di kot kom tok sey mek dey go kil-am by kotin e hed komot. For 24 December 1635, dey komot Hester Jonas hed. Dey put faya for e dead bodi an hashes wey rimen, dey skata am for all di Four aria of di ples. Di rekod of how evritin tek happun dey di siti rekod of Neuss.

Smol informashon abaut am[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • "The ballad of Hester Jonas" by Peter Maiwald
  • German folk rock band Cochise sing one song for Jonas.