Helen Heffron Roberts

From Wikipedia

Helen Heffron Roberts ( dey bon am in 1888 an e kpai in 1985) na Amerika wuman wey dey stodi kolsho an e dey also stodi how difren kolsho dey mek muzik. Roberts wok na to luk into di horijin an how muzik tek divelop among di Jamaika pipul an di Pueblo pipul wey dey stey d Southwest of Amerika. Roberts rekodin of old Hawaii song dey Bernice P. Bishop Musium in Hololulu wey dey kip am. Na Alfred V. Kidder an Franz Boas train Robert

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Chikago dey bon Roberts on June 12, 1888. Na Roberts bi di sinior pikin among di three pikin-dem wey e peret bon. Roberts papa nem na William Hinman Roberts an e mama nem na Dana Alma McDonald Roberts. Robert papa wok na hakantant an e mama na aktist. Wen Roberts dey smol, e peter buy piano for am an dey hep am so dat e go sabi play di piano wel wel. Wen e finish e pamari an sekondri edukeshon in Monticello Seminari, Roberts go kontiniu e edukeshon from Chikago Musikal Kolej an e finish in 1909 an e stil finish Amerika konsavetori of Muzik in 1911.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Roberts dey muzik skul, e kom see sey e no fit bi wetin e papa an mama wan mek e bi: pesin wey go Dani play piano wel wel. Na bikos of di sikness wey e get an e hand wey no fit play di piano wel mek am no dis fact.

Wen Robert wan too for one tok wey e du, e tok sey e no bi popular pesin wey sabi play piano bikos of e sikness an sey e like Nativ Amerika kolsho pass di piano lessin. Dis two tins mek am travul go Southwesta United States. Ova di years, e kontiniu to join muzik klass wit tishin muzik inside klass in Kansas, Texas.