Heidi Aklaseaq Senungetuk

From Wikipedia

Heidi Aklaseaq Senungetuk na Alaska wuman wey bi professor wey dey stodi how difren difren kolsho dey mek muzik an e stil bi muzishan. E na pikin of Ronald Senungetuk an Turid Senungetuk. Senungetuk stil bi gran-pikin of Helen and Willie Senungetuk. Na from [Wales, Alaska]] bi di orijin of e famili histri. Senungetuk gro up in Fairbanks. E papa fom di Native Art Center an e stil bi di head of dipatmet of Akt at di Yunivasiti of Alaska.

Na from Wesleyan Yunivasiti Senungetuk tek du e Ph.D in "Ethnomusicology". Wetin e wok on for e Ph.D na how native pipul dey du muzik an dans in di siti aria wey de araund di Arctic

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Heidi Aklaseaq Senungetuk get e Bashelor an Masta digri from Oberlin Kolej Konservetori of Muzik an di Yunivasiti of Michigan Skul of Muzik. Na how to play an paform Violin e go rid. Wen e din kolet e Ph.D satifiket in "Ethnomusicology" from Wesleyan Yunivasiti, e wok for McGill Yunivasiti as di fest post-graduate risasha in lokal langwej. Na Senungetuk bi di fest skolar in Yunivasiti of Alaska Archorage wey dey tish Alaska Native Stodis. Senungetuk dey tish "ethnomusicology" as assistat professor at di Yunivasiti of Alaska Anchorage. Senungetuk get posishon at di Louisiana Philharmonic wey de New Orleans as pesin wey sabi play Violin. E stil get posishon in di Tulsa Philharmonic, in di Breckenridge Muzik Festiva in Colorado, in di Anchorage Symphony Orchestra.

Senungetuk don pafom yuzin di Violin in front of pipul at di "Inuit Artist's World Showcase" wey happun for Inukjuak in Kanada. E stil don pafom at di Nashonal Musium of di Amerika Indian wey de Washington, D.C in dia klasika siris. Senungetuk don pafom at di Nashonal Gallery of Arts an for di Amerika Musium of Nashoral Histri