Hausa pipul

From Wikipedia
(E kom from Hausa Pipul)
Jump to navigation Jump to search
Hausa pipul
ethnic group
Fest langwejHausa langwej Chenj-am

Hausa pipul na di etnik grup wey plenti pass in West an Sentral Afrika. Hausa pipul dey spik di Hausa langwej an Hausa langwej na im bi di sekod langwej afta Arabic wey pipul dey spik pass for Westa Asia, North Afrika an pat of Sahara/Sahel. Hausa pipul difren bot dey get di sem Kolshor an you fit see dem for Niger an Norta Naijá. Hausa pipul go rish 54 million an you fit also find dem in Benin, Kameroon, Ivory Coast, Chad, Sudan, Central Africa Republic, Republic of Congo, Togo, Ghana, Eritrea, Equitorial Guinea, Gabon, Senegal an Gambia. Hausa spikin komuniti skata for all di West Afrika an di Sahara an you go see plenti of dem in di town kol "Agadez".Som Hausa pipul don muv to Siti like Legos, Port Harcourt, Accra, Abidjan, Banjul an Kotonu an pat of North Afrika like Libya ova di last 500 years.Di Hausa pipul dey live for smol vilej as wel old town an siti wie dey plant krop an raise Animal.Som Hausa stil dey bai an sel in lokal an long distans akros Afrika. Hausa pipul like to dey yuz horse to dey waka an pipul for Hausa wey get moni dey travul on horse.Wen Hausa pipul wan du selibeshion like Eid day or Ranar Sallah (Inglish Day of Parsya), Dem dey yuz horse sho dat day. Dauda Siti na di korshoral sentar for all Hausa pipul bikos na di town old pass in tradishion an kursho amog all Hausa vilej or town.

Populashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ova di 500 years wen don pass, Hausa pipul don waka di hol Afrika for risin like Militri savis, to Bai an sel, to find fud to chop, to go Mecca, to run for proteshion or to tok abaut Islam.

Histri of Hausa pipul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Daura, wey dey Norta Naijá bi di oldest Siti for Hausaland.Di Hausa pipul wey dey Gobir for Norta Naijá dey spike di oldest Hausa.Na Kastina fest get nomba of Hausa wey go skul pass bifor Sokoto kom pass am bikos of wetin Usman Fodio du wen e dey arenj how Islam go bi like. Di wey Hausa pupil dey du tins wan resembu oda etnik grup like di Fula, di Zarma an Songhai (in Tillabery, Tahoua an Dosso in Niger); di Kanuri an Shuwa Arabs (in Chad, Sudan an North-East Naijá); di Tuareg ( in Agadez, Maradi an Zinder); di Gur an Gonna (in North-Easta Ghana, Burkina Faso, Norta Togo an orpa Benin); di Gwari (in Sentral Naijá); an di Mandinka, Bambara, Dioula an Soninke (in Mali, Senegal, Gambia, Ivory Coast an Guinea)

Difren difren grup wey mek Hausa pipul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hausa pipul bi di "Kasar Hausa" wey dey stey in West Africa. Hausa pipul dey klass demsef into three grup: Habe, Hausa-Fulani an Banza or Banza 7.

  • Habe bi di pure Hausa pipul. Dey bi Gobirawa, Kabawa, Rumawa, Adarawa, Maouri an odas. Di Habe dey rul an kontrol di Hausa kingdom Buford Danfodio fight (Jihad) of 1804.
  • Hausa-Fulani or Kado bi di Hausa an Fulani orijin. Dem dey spik one kind Hausa as dia papa langwej.Akordin to histri of Hausa orijin, na di Fulani wey kom liv for Hausa land in di 15th sentuari an leta in di biginin of 19th sentuari dorin Usman Danfodio kwerel against di Hausa kindom wey lid to Sokoto kalifat.( Sokoto kindom). Di grup wey mek up Hausa-Fulani bi Jobawa, Dambazawa, Mudubawa, Mallawa, an Sullubawa traib wey dey kom fom "Futa Toro".
  • Banza or Banza 7 bi di Hausa grup wey old pass amog di Hausa grup bot di Hausa wey dey spik no dey again.Pipul no tu no tins about Banza pipul like dat.Di grup wey mek up Banza grup bi Ajawa, Gere, Bankal an odas.

Rilijion[chenj-am | chenj-am for orijin]

Islam rilijion don dey Hausa land sins 11th sentuari an meni pipul wey sabi Islam don kom prish in Kastina like Wali Muhammad dan Masani (e dai 1667) an Wali Muhammad dan Marma (e dai 1655)