Hannah Idowu Dideolu Awolowo

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Hannah Idowu Dideolu Awolowo
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemHannah Chenj-am
Wen dem bon am25 November 1915 Chenj-am
Ples wey dem bon amIkenne Chenj-am
Wen e kpai19 September 2015 Chenj-am
Pesin wey e mariObafemi Awolowo Chenj-am
PikinAyodele Soyode, Segun Awolowo Sr. Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Wie e go skulMethodist Girls' High School Chenj-am
Party wey e dey for politisUnity Party of Nigeria Chenj-am

Chief Hannah Idowu Dideolu Awolowo (November 25, 1915-September 19, 2015) wey pipul no wel wel as HID na Naijá bizness wuman an politishian.Dey stil no am as Adelana.

Dem bon am inside one beta famili inside small kominiti wey dem dey kol Ikene wey dey inside Ogun stet for Naijá. Adelana go skul for Methodist Girls' High School for Legos. E mari one man wey dey du politiks matta wey bi Obafemi Awolowo from December 26, 1937 ontil e kom dai for 1987.Awolowo dey always kol im waif "shine-shine stone wey dem no fit talk about talk finish". Hannah still bi wuman wey sabi du biznes an kom stil get beta sens for politiks matta. E rili put bodi for di Western Nigeria politiks. Wen dem jorge e hosband matta for kot, dey kom put am for inside prizin, na Hannah stand for im hosband for di taim wey NCNC and AG join-bodi kom be United Progressive Grand Alliance (UPGA).

Di plan bi sey, if e win for di big elekshon, e go komot mek im hosband kontinu wen dem du small elekshon. Hannah wan mek sure sey na hosband rul for di Sekond Repoblik na im mek am folo e hosband waka rich evriwie for Naijá dey beg pipul mek dey vote for e hosband. Na Hannah kom dey arenj evriitin wey dey happun for di wumen dem side for dis dia politiks grup wey dem dey an e dey always dey for all di meetin wey dem dey du. E rili mek am for di biznes wey dem dey du, she kom bí di fest pesin for Naijá wey dey supply maket for Nigerian Tobacco Company (NTC) for 1957. Na Hannah bi di fest pesin wey buy lace material and oda matiria wey dem dey yuz sow klot fom anoda kontri enta Naijá. Hannah get plenti taitu, dem kom stil giv am di taitu wey bi Yeye Oodua of Yorubaland. Na September 19, 2015 e dai.By den Hannah dey 99 years an na jost two month rimain for am to du im 100 years birthday. Dem beri am near im husband for Ikene for November 25, 2015. Di sekond pesin for Naijá afta di presido wey dem dey kol Yemi Osinbajo mari e granpikin wey e nem na Dolapo Soyode.