Hadiza Aliyu

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Hadiza Aliyu wey pipu sabi as Hadiza Gabon (bon 1 June 1989)Dem bon ha for Libreville , Gabon. Shi bi Naija aktress and fim produsa, shi dey akt inside Hausa and inglish fim. Shi bi MTN ambassador for MTN Naijá and indomie noodles company tu. Shi wein di 2nd Kannywood/MTN Awards for 2014. Na shi bi person wey stat HAG Foundation.

how e tek stat e laif an famili[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Libreville in Republic of Gabon dey tek bon Hadiza Aliyu.Hadiza papa nem na Malam Aliyu wey bi elda statesman. For e papa side shi bi Gabonese pikin an for e mama side shi bi Fulani wey kom fom Adamawa State for Naijá. Shi go pramari an sekondri skul for Gabon, where shi rait im A-level Ezamination to rid lo. Hadiza enta Univasiti bot shi no fit finish bikos of som kind tins wey happun, shi kom go du one diploma in French langwej, shi kom bikom French ticha for one private skul

Ha Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

I no tay wey shi kom Adamawa state for Naija na I shi enta Kannywood , shi komot for Adamawa go Kaduna with one of ha kosine bikos they won join bodi enta Kannywood, Hadiza mit Ali Nuhu and shi beg am for a rol inside im fim, Hadiza akt ha fest fim for 2009 inside one fim wey dem dey kol Artabu, shi kom bikom popula for Kannywood fim industry as one of the ogbonge female aktress wey sabi akt bikos Ali Nuhu and Aminu Shariff help ha wel wel. For 2017, Hadiza join bodi with Nollywood lik Ali Nuhu, Sani Musa Danja, Yakubu Muhammed, Maryam Booth and Rahama Sadau, shi akt ha fest Nollywood fim with Mike Ezuruonye, Mark Angel and Emmanuella for one fim wey I nem bí Lagos Real Fake Life.